You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Activist Oliver Barker-Vormawor apologize for birbery allegations as Ghana parliament vetting committee summons
- Author, Komla Adom
- Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
- Reporting from, Accra
- Read am in 7 mins
Controversial activist Oliver Barker-Vormawor don apologize to di appointment committee of parliament for im post wey bin suggest say president John Mahama im appointees don dey pay moni for di committee to approve dem.
Di committee bin summon Oliver on Tuesday afta di post on social media cause sakala.
Di 11-member appointment committee begin to vet di ministers on 23 January.
So far di committee don approve many of di ministers wia di president don already swear dem in.
But activist Oliver Barker-Vormawor wey begin di #FixTheCountry movement don tok say di committee don dey collect moni from di nominees.
Inside one post for social media, im write say "so all di moni dem dey ask di ministerial appointees to pay to di appointment committee just to approve dem, di goment 'operation recover all loot' ORAL no dey affect dem.? Dis na strange republic."
Na so di chairman on top di committee don vex during Tuesday sitting wey im tok say make di activist appear bifor di committee to prove di allegations.
Inside di summons wia parliament don issue, dem tok say Oliver also bin tok say di goment lawmakers for di vetting committee also bin dey collect bribe from di ministers
End of Di one wey oda users dey read well well
"You also tok on 25 January for one outlet say NDC members for di vetting committee collect money from Mahama im appointees bifor dem go approve dem. Di deputy speaker of parliament (di chairman of di vetting committee) gat to submit imserf to di ORAL team," di statement from parliament add.
Di committee say dem dey take di allegation of bribery and corruption seriously wia dem tok say make di activist appear to provide evidence.
Even tho di committee don approve many of di ministers, e neva be without drama. Dis na some of di tins wia happun for di vetting
Oliver apologize to di committee; reject anoda comment
Oliver bin show up wit ogbonge lawyer Nana Ato Dadzie wia im try to guide am for di committee.
As dem start, di committee members tok say make Oliver explain wetin im write on top social media.
Na so im lawyer tok say im no go gree make Oliver tok, na im go tok give ma.
Lawyer Ato Dadzie explain say from di two statement wia di committee attribute to di activits, im write only one of dem, di oda one na fake news.
Oga Ato Dadzie explain say "Oliver bin write wetin im write as whistleblower wey don dey bring attention to sometin make di authorities investigate."
"Oliver im post no mean say im get evidence say pipo pay money to di committee but na tins pipo dey tok around wey im write for social media," di lawyer tok.
Some of di committee members insist say make Oliver tok for imserf.
Na so im begin to explain say im go give context bifor di apology.
"Di post i make no be to tarnish di image of di members of di committee wia i also neva get mind to tok say di members of di committee collect or ask for bribes from pipo. Na so i apologize."
Di committee members bin ask am why im no delete di post, Oliver tok say "i don leave di post sake i bin see say pipo don twist wetin i write, na so i gat to keep di original post so dat if pipo ask question about am, i fit to use am as reference."
Di chairman of di committee Bernard Ahiafor bin ask Oliver to remove di post on top social media and issue disclaimer about di oda one wia im tok say na fake.
Defense minister Dr Edward Omane Boamah bin spend at least six hours bifor di committee.
Members for di committee bin ask am questions about di sector and wetin im go carry enta di ministry to change tins.
Di opposition ranking member on top di committee - wey be minority leader for parliament Alexander Afenyo-Markin don kwesion di minister well well.
Im manage to ask di minister kwesions about im tax payment, some of im previous comments wia im make for political platform and oda places among odas.
Na so di minister don tok say im apologise for some of di comments, but for odas, im stand by dem.
'No deny me protocol allocation sake of I don grill you'
Afta di six hours wia di minister sit bifor di committee to answer questions, di ranking member don tok say make di minister no deny am protocol allocation for di military.
"Di fact say I don dey grill you for dis committee neva mean say if you become minister for defense, you go deny me my protocol allocation," di majority leader and ranking member for di appointment committee Alexander Afenyo-Markin tok.
Na so members of di committee begin to dey argue on top di committee, but di lawmaker insist say protocol allocation for di military don dey happun.
"Protocol allocation for members of parliament bin dey happun, members of di defence committee of parliament don benefit from dis kind tin, di time I bin dey on top dat committee."
"All di members on top dat committee benefit, including di opposition MPs at di time," Afenyo-Markin tok.
Many sabi pipo tok say dis kind protocol recruitment for di security service don dey weaken di military and di police.
One minister appear bifor di committee wia last for only 5 minutes
One of di tins wey cause drama on top social media on Tuesday na wetin happun as Greater Accra regional minister Linda Ocloo bin appear bifor di committee.
Di minister spend only five minutes for di committee.
Afta she take im oath, dem bin ask am say make she tok di vetting committee about imserf.
Na so dem tok say dem discharge am from di vetting, within 5 minutes.
Even di minister herself don shock.
Ranking member for di vetting committee Alexander Afenyo-Markin tok say "sake of di way you bin dey conduct yourself for parliament since you join, you bin show good character, na so di chairman of di committee go discharge you."
Many pipo bin tok say di committee neva try as dem gat to question di minister wetin im dey carry enta di ministry and how im go do im work.
Oga of governance think tank IMANI Africa bin tok say na pity.
"So who be dis greater Accra regional minister and wetin be im plans for Accra? Na pity say di vetting committee neva ask am even one question bifor dem discharge am," oga Franklin Cudjoe don tok.
One vetting committee member complain say one goment appointee abuse am
During di long hours of di vetting of di defense minister, chairman for di committee Bernard Ahiafor bin suspend sitting sake of some members no gree on many tins.
Afta dem resume sitting, one MP Frank Annor Domoreh and one goment appointee wia im name na Emeafa Hardcastle don exchange words.
Inside one viral video, di appointee, CEO of di petroleum commission Emeafa Hardcastle tok say "you dey threaten say you go take me on, sake of you be who.?"
Di MP respond say "you don dey ask say I be who?
Di CEO also respond wia im tok say "my friend make you no bring yourself."
Oga Frank Annor Domoreh also ask "wetin you dey mean by dis tin you tok?"
Na so di MP go tok di speaker of parliament for di chamber say make im take action against di CEO.
"Pipo tink say dem fit to take tins for dia hands and turn parliament into punching bag sake of we no dey deal wit dem."
Oga Dompreh tok say "Mr Speaker, I don dey invite you to give order to deal wit dis mata, I be pesin wey dey respect womanhood, na so I dey calm as di CEO bin dey abuse me."
Speaker of Parliament Alban Bagbin tok say im go deal wit di mata.