Wetin we know about di petrol tanker explosion for Niger state wey burn pipo to death

Petrol tanker wey catch fire for Niger state

Wia dis foto come from, Mikail Musa

Read am in 6 mins

Dozens of pipo fit don die and several odas injure afta one tanker wey carry petrol explode for Niger state, north-central Nigeria.

BBC News Pidgin don see pictures and videos wey show pipo wey burn to death and pipo wit different degrees of burns for hospital.

Although di casualty figure never clear yet, di state Govnor Mohammed Bago wey also confam di incident tok say di tanker explosion hapun for Katcha local govment area of di state on Tuesday, 21 October and e claim many lives and leave several odas injured.

According to one statement wey im Chief Press Secretary Bologi Ibrahim issue, pipo bin dey scoop fuel from di fallen tanker, bifor e explode wey lead to di death of many pipo and several odas sustain various degrees of injuries.

"E dey very sad how pipo go continue to approach fallen tanker to scoop dia contents despite several sensitisation on di danger of such action," e tok.

Di govnor describe di incident as worrisome, unfortunate, and pathetic.

Dis no be di first time wey dis kain incident go occur for di north-central state.

For January, Niger State Emergency Management Agency (NSEMA) tok say 86 pipo die from one tanker explosion wey happun for di state.

Tips to avoid tanker explosion incidents

For di ways to avoid dis kain disasters in di future for Nigeria, Oga Emmanual John tok say, "we need to renew di vehicle fleet, policy wey go say if your truck don reach certain age or certain maintenance level, you go exit di fleet," John tok.

E add say, "Nigeria need to improve im technology wey go support traffic rules wey no require you to go stand on di road to stop truck, wey be di current practice."

Di last tin na when di tank fall, make citizens stop to dey go close, no matter how juicy e look.

"Make citizens stop to dey go near truck wey fall becos when you get close na you go pay di high price."

On di oda hand, Oga Abubakar tok say di measure wey go help avoid dis kain incident in di future na for di goment to repair roads wey bad, do traffic control and also make pipo know how dangerous e be anytime dem dey around fuel tankers wey fall.

E add say for many developed kontiris, traffic control dey wia e dey veri hard for fuel tankers to dey carry loads during di day or even travel for road.

Burnt part of di petrol tanker wey explode for Niger state

Wia dis foto come from, Mikail Musa

Wetin we call dis foto, Statement from govment say pipo bin dey scoop fuel wen di tanker explode.

Di govnor say relevant authorities don carry dos wey injure go Federal Medical Centre Bida for medical attention. E also pray for di souls of pipo wey die.

Chairman of di Niger State Tanker Drivers Association and National Ex-Officio of di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG), Comrade Farouk Kawo tell Channels TV say di tanker bin dey carry petroleum products from Lagos go di northern part of di kontri wen di accident occur.

Kawo claim say more dan 30 tanker accidents don hapun along the Bida–Agaie route for October alone. E blame di increasing accidents on di terrible state of di road.

Bicycle wey burn

Wia dis foto come from, Mikail Musa

Tanker fire accident for Nigeria

Tanker fire no be new tin for Nigeria. Di West African kontri dey suffer from one tanker fire or di oda afta dis tankers fall.

Di tankers wey dey carry thousand of litres of mostly petroleum products like Premium Motor Spirit (PMS)popularly known as fuel dey fall sake of bad roads.

For October, 2024 one tanker wey dey carry fuel explode wey kill 153 pipo for Jigawa State, wey dey northern Nigeria.

Di police tok-tok person for di state, DSP Lawan Shiisu Adam, tell BBC Pidgin say di number bin increase to 153 pipo wey die, and about 100 pipo injure wia dem collect treatment for Aminu Kano hospital, Jahun, Nguru, Hadejia and Gumel hospital.

Dem bin do funeral prayer and bury some of di victims near where di accident happun sharp-sharp.

Also for March, at least, half a dozen pipo bin kpai fromone petrol tanker explosion wey happen for Karu, one suburb of di Nigeria capital Abuja, according to official figures.

Why dis kain accidents continue to dey hapun for Nigeria?

Fuel tanker explosions and accidents dey common for Nigeria.

Experts tok say bad maintenance of vehicle and roads dey among di tins wey dey cause truck accidents wey sometimes dey lead plenty pipo to die.

One safety expert Engineer Emmanuel John, CEO of Ochenwa Mobility, wey be Sustainable Transport and Road Sector Organization wey dey for Abuja bin tell BBC News Pidgin say many factors na im dey cause dis kain of accidents

"Number one na di state of trucks and tankers for Nigeria.

One data from di Federal Road Safety Corps tok say 90% of di trucks on our roads don reach 30 years old and above. E mean say we get a fleet of trucks wey dey old and poorly maintained, carrying fuels, and so dat na why dem dey accident prone.

For Nigeria, no mata how old di vehicle dey, as long as di tyre dey turn and di engine can move am, you go see am for road."

Oga John add say, "anoda reason na di general safety issues and di enforcement of traffic rules for di trucking subsector wey dey very difficult.

"FRSC and oda traffic agencies focus on physical arrest of vehicles."

E add say di greed of pipo wey dey take advantage of tanker wey fall and wey wan fast-fast scoop fuel to make quick money also join.

"Of course, many pipo dey attribute am to poverty, but poverty no mean say you go go die wen you see fire dey burn.

If tanker fall and fuel dey run like water e dey equal to fire, if you go dia e mean say you don sign to go die."

Anoda expert, public commentator Kabiru Abubakar bin tell BBC News Pidgin say many pipo go see dis incidents like natural disaster but di truth na di bad roads dey cause am and also di way pipo wey dey live around no dey see di disaster wey fit come from am.

"Di first tin be sa,y Nigerian roads dey really bad and na di reality be dat.

Di second one na di traffic control, e suppose be say big trucks go only dey move for night, di time wey temperature don cool down." Abubakar tok.