AfroBasket 2025: Nigeria sama Mali wotowoto for historic fifth back to back title and seventh overall

Read am in 3 mins

Nigeria women basketball team, D'Tigress, don win dia seventh African basketball title.

Dem sama Mali 78-64 to win di title back to back five times and become di first African side to achieve dis feat. Dis final wey dem win, repeat di 2021 AfroBasket final wen dem bin face Mali.

Mali bin dey lead Nigeria 25-21 for di first quarter. For di second quarter, Nigeria bin try to up dia game but Mali play well, dem no give Nigeria space as e end for tie: Mali 41-41 Nigeria.

For di third quarter di two kontris bin take di lead at intervals but Nigeria win di quarter 61-56 against Mali.

Nigeria Coach, Rena Wakama bin dey make tactical inputs during di break. Di Malian coach too no rest as e dey make changes too.

Coach Rena Wakama wey bin win di trophy for 2023 and also set record as di first female coach to win di title bin tell BBC Pidgin say she bin don always dream to be coach and to win trophies.

Nigeria don win di AfroBasket overall seven times - 2003, 2005, 2017, 2019, 2021, 2023, 2025.

Nigeria President Bola Tinubu bin tell D'Tigress say dem don bring honour to Nigeria wit dia "discipline, focus and team spirit" for di 2025 Women AfroBasket afta dem beat Senegal for di semi-final.

Di president praise D'Tigress for inside statement afta di team qualify for dia fifth straight AfroBasket final.

Meanwhile, former vice president Atiku Abubakar also congratulate di team too afta dem reach di finals.

''Congratulations to D'Tigress, Nigeria senior women basketball team for reaching di finals of di 2025 FIBA Women's AfroBasket.''

On Saturday, Nigeria defeat Senegal 75-68 for di semi-final of di competition wey dey happun for Ivory Coast.

Wit dis win Nigeria don secure automatic slot to play for di 2026 FIBA Women World Cup for Berlin.

for di third place match, first timers South Sudan shock 11-time African Champions, Senegal 66-65 to win bronze.

South Sudan also qualify for di 2026 World Cup qualifiers and 2027 AfroBasket Championship.