Femicide: '140 women and girls dey die every day for di hand of dia intimate partner or family member'

Salome Adaidu, Augusta Oseodion Onuwabhagbe and Yetunde Lawal be victims of femicide for Nigeria

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Facebook, @AUSTA_XXO, SIKIRULAI ANDE

Read am in 5 mins

United Nations latest femicide report reveal say dem intentionally kill 85,000 women and girls globally for 2023

Most of dis women, 60% wey be 51,100, na dia intimate partners or family members kill dem.

Di data show say 140 women and girls dey die every day for di hands of dia partner or close relative, wey mean say one woman or girl dey killed every 10 minutes.

Di UN Women and UNODC wey release dis report on di International Day for di Elimination of Violence against Women on Tuesday, 25 November, tok say femicide wey be di most extreme form of violence against women and girls still dey high globally.

Out of dis number, Africa get di highest number of gender-related killings, wit 21,000 reported cases of femicide.

For Europe and di Americas, most women wey die sake of domestic violent (64 per cent and 58 per cent, respectively) be victims of intimate partners, while for anoda place, family members na di primary perpetrators.

Ajayi Ololade, one gender activist and founder of DOHS Care Foundation, tok say e be like say di incidents of femicide dey on di rise, wit 32 reported cases between January and March 2025.

Also, Nigeria first lady, Oluremi Tinubu for her remark to mark di day tok say di theme wey be "Unite to end digital violence against all women and girls" speak to di urgent need to address di growing threat of online abuse wey women and girls dey face.

She call on Nigerian govment institutions to take bold action wey go make digital spaces dey safe.

"Digital spaces suppose foster genuine human connection, facilitate learning, and promote productivity not fear. Yet, too many women and girls dey face bullying, blackmail, stalking, and gender-based hate online. Dis dey unacceptable. Violence in any form, offline or online, undermines di dignity, safety, and di potential of women and girls." Remi Tinubu tok.

 Nakuru human rights activists march in the streets while chanting slogans to demonstrate against rising cases of violence against women during this year's International Human Rights Day

Wia dis foto come from, James Wakibia/SOPA Images/LightRocket via Getty Images

Victims of femicide for Nigeria

  • Deborah Moses

Di latest case of femicide for Nigeria na dat of 25-year-old Deborah Moses, wey her former boyfriend Lintex Ogale allegedly stab to death, nearly two years afta she end dia relationship.

Reports say di incident hapun on Thursday, 4 September for her house for Lagos and police don since arrest di suspect.

According to Deborah father Dr Moses Okwori, di suspect bin disguise as dispatch rider enta her house, as she try to run, e stab her repeatedly.

  • Salome Adaidu

Anoda case na dat of 24-year-old youth corps member, Salome Adaidu, wey bin go viral for January 2025.

Police bin gbab Timileyin Ajayi wey say e be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January near one church for Orozo, Nasarawa state.

One video wey bin go viral on social media, show as pipo surround Ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head of di lady wey be corps member.

E tok say Adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year. But Salome family deny am.

Tori be say Ajayi allegedly murder Salome wen she bin visit am for im house for Papalana axis for New Karshi for Karu local goment area of Nasarawa State.

Police bin parade Timileyin wit di knife and machetes wey im bin allegedly use commit di crime.

For June 2025, one High Court for Lafia, Nasarawa State, sentence Oluwatimileyin Ajayi to death by hanging for di death of di corper.

Justice Simon Aboki find Oluwatemileyin Ajayi guilty of killing and dismembering (cutting to piece) di late Salome Adaidu.

  • Yetunde Lawal

High Court for Kwara State, southwest Nigeria, bin sentence di killer of Yetunde Lawal, Abdulrahman Bello, to death by hanging.

Abdulrahman bin chop accuse say e murder di 23-year-old student of Kwara State College of Education, Ilorin, for February 2025.

Late Yetunde na di first pikin of her family. Her papa and mama still dey alive. She bin dey final year for Kwara State College of Education, Ilorin, bifor di incident hapun.

Security personnel find di dismembered bodi of Yetunde inside bowl for di suspect house.

Tori for town be say dem both meet online and begin friend till di suspect invite her over to im place for Olunlade area of Ilorin on 10 February 2025, di day wey e commit di crime.

Augusta Onuwabhagbe Osedion

Anoda femicide case wey bin go viral na di alleged murder of Augusta Osedion by her boyfriend.

For 2023, Lagos police bin declare Benjamin Best Nnanyereugo aka 'Killaboi' wanted ova di murder of im 21-year-old girlfriend Augusta Onuwabhagbe Osedion.

Dem say di suspect murder im girlfriend on July 13, 2023, for im house for Oral Estate, Ajah home.

28-year-old Nnanyereugo bin confess on im Instagram story say im mistakenly stab im girlfriend to death afta one argument.

SP Hundeyin say DPO of Ajah police station wey lead detectives to im house, discover di lifeless body of Augusta.

Nnanyereugo bin run go Sierra Leone wia e bin remain free man until e dey rearrested on October 20, 2023, under di false identity, 'Kanu Princeton Samuel'.

But e again bin escape custody during one prison break for Freetown on November 26, 2023. According to di Nigeria police, e bin travel through multiple regions including West Africa, East Asia and di Middle East, under forged identities bifor e eventually relocate to Doha, Qatar on January 24, 2025.

For dia, e bin live under di alias 'Toure Abdoulaye' wit forged Guinean passport before im arrest for February and den repatriation to Nigeria for April 2025 to stand trial.

Wetin be Femicide?

UN say di new femicide report highlight di urgent need for strong criminal justice systems wey go hold perpetrators accountable, and ensure adequate support for survivors, wey include access to safe and transparent reporting mechanism.

Femicide dey defined as di intentional killing of women and girls sake of dia gender. More dan half of dis murders dey hapun for dia house.

E dey different from homicide, wia di motivation fit no be gender-related.

According to di UN, femicide dey driven by discrimination against women and girls, unequal power relations, gender stereotypes or harmful social norms.

Na di most extreme and brutal manifestation of violence against women and girls wey dey occur mostly for house, workplaces, schools or public and online spaces, including intimate partner violence, sexual harassment plus oda forms of sexual violence, harmful practices and trafficking.