Chad opposition leader Yaya Dillo die for shootout with security forces

Yaya Dillo

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO

Wetin we call dis foto, Opposition politician Yaya Dillo na vocal opponent of im cousin, President Mahamat Déby

Officials don confam say one opposition leader for Chad die during one shootout wit security forces.

Yaya Dillo death dey come afta di goment blame am for one deadly attack on di kontri security agency.

E bin deny di accusation.

On Wednesday, pipo bin hear heavy gunfire near im party headquarters for di capital, N'Djamena.

Oga Dillo na loud opponent of im cousin, President Mahamat Déby, wey don dey power since 2021.

Oga Déby bin take ova from im father wey rebels kill afta thirty years in power.

Di kasala for di Central African kontri dey come afta di announcement say presidential elections go hold on 6 May.

Dis elections na to return di kontri to constitutional rule.

Yaya Dilli

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO

Wetin we call dis foto, Opposition politician Yaya Dillo na vocal opponent of im cousin, President Mahamat Déby

Communications Minister Abderaman Koulamallah tell AFP news agency say Oga Dillo die on Wednesday "wia e run go hide, for di headquarters of im party. E bin no wan surrender and e shoot law enforcement".

On Wednesday, Oga Dillo tok say di intention of di accuse say na im dey behind di attack on di National Security Agency (ANSE) headquarters na "to make me afraid so I no go go di election".

One of Oga Dillo colleagues, di general secretary of im Socialist Party Without Borders (PSF), tell Reuters news agency say PSF members come under attack from sojas outside di ANSE building as dem dey try to retrieve di body of dia colleague Ahmed Torabi.

Di PSF official say dem arrest and kill Oga Torabi on Tuesday, before dem dump im body for outside di ANSE building.

According to di goment, Oga Torabi bin dey attempt to assassinate di president of di Supreme Court.

Dem shoot relatives and party members wey dey try to get im body on Wednesday morning, and e don lead to multiple fatalities, di general secretary tok.