'Dem don take away everytin wey I build' - Pogba react to football ban

Wia dis foto come from, Getty Images
Juventus midfielder Paul Pogba say im dey "sad, shocked and heartbroken" afta dem ban am from football for four years for a doping offence.
Dem bin provisionally suspend di 30-year-old France international for September afta one drug test see elevated levels of testosterone for im system.
"Dem don take away everythin I don build for my professional career," e tok for one statement.
Di former Manchester United player add say im go appeal di case.
Dem randomly test Pogba afta Juventus first match of di season on 20 August.
Italy national anti-doping tribunal confam di positive test for one second sample for October, and di anti-doping prosecutor office bin request a four-year suspension.

Wia dis foto come from, Paul Pogba/Instagram
Juventus tell BBC say dem receive notification from di anti-doping tribunal on Thursday morning.
Pogba tok say im believe say di verdict dey "incorrect" and im no go "never knowingly or deliberately" dope.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Wen I dey free of legal restrictions, di full story go become clear," e tok.
"As a professional athlete I no go ever do anything to enhance my performance by using banned substances and I no ever disrespect or cheat fellow athletes and supporters of any of di teams I don play for, or against."
Di ruling mean say Pogba no go fit play until 2027, wen e go be 33, as dem backdate di ban to di date of di failed test.
Pogba agent, Rafaela Pimenta, wey tok for di time of di initial suspension, say: "Wetin dey sure na say Paul Pogba no ever wan break rule."
Testosterone na hormone wey dey increase di endurance of athletes.
Nado say Pogba don violate rules wen dem see banned non-endogenous testosterone metabolites for di test, and di results bin dey "consistent wit di exogenous [external] origin of di target compounds".
Juventus bin sign Pogba on a four-year deal for July 2022 afta di player contract wit Manchester United end and e comot as free agent.
Constant injury problems affect Pogba return to Turin wey also make am miss last year World Cup for Qatar.
Pogba don play a total of 51 minutes as a substitute dis season inside games wit Bologna and Empoli.
Last season, e play 108 minutes ova six Serie A games, make three appearances and one assist for di Europa League, and manage 11 minutes for di Coppa Italia - a total of 162 minutes and no goals.














