President of Chad Idriss Déby dead: Déby die for frontline of Chadian rebels, Tchad leader son General Mahamat announced as interim leader

Wia dis foto come from, Foreign and Commonwealth Office
Chad President Idriss Deby Itno don die of injuries wey e suffer for frontline attack.
"President Idriss Déby of Chad "breathe im last breath as e dey defend di sovereign nation on di battlefield".
Na wetin di kontri Army tok tok pesin General Azem Bermandoa Agouna for inside statement wey e read for state television.
Di Chad long-time ruler bin win re-election for a sixth term for office, just dis morning.
According to provisional results wey dem publish for Monday by di kontri National Independent Electoral Commission, oga Deby bin win di election by nearly 80%.
And oda 9 opposition candidates, including some wey don withdraw from di race share di remaining votes among themselves.
Di Constitutional Court suppose declare di final results on May 15.
Chad army dey currently combat rebel forces wey launch attack on di capital N'Djamena.

Idriss Déby Itno death: Im son [General Mahamat Idriss Déby Itno] na new interim lead of Chad
General Mahamat Kaka, son of late President Idriss Déby don dey appointed as di kontri leader.
Di four-star general go replace am for di head of a military council.
Kaka go be di interim military leader in charge of Chad transition goment for now.
Di military also announce curfew from 6pm to 5am until further notice.
Im papa Déby injure wen e dey vist troops wey dey fight rebels wey launch major movement last week from dia base for Libya, army tok.
Di 68-year-old leader enta power through coup for 1990.
Dem dey always praise am for im effort in fighting insurgency.
For 2020, e receive award of di highest military rank of Field Marshal sake of im efforts.
He bin ready to lead di kontri for a sixth term afta e secure a huge lead for di provisional results dem announce on Monday.
Di army announce say dem don dissolve goment parliament.









