Finidi George confam resignation as Super Eagles coach

Finidi George

Wia dis foto come from, Getty Images

Finidi George don confam say im resign from im position as Super Eagles Head Coach.

Though di Nigeria Football Federation neva officially comment on di resignation. And e neva clear if dem go accept di resignation.

Dis dey come afta di NFF bin tok say dem go hire a foreign technical director for di Super Eagles.

Dem make dis decision afta one emergency meeting of di NFF Executive Committee on Wednesday 12 June.

"Di Executive Committee resolve to employ expatriate Technical Adviser for di Super Eagles in di coming weeks, ahead of di AFCON qualifiers and di remaining FIFA World Cup qualifying matches," NFF statement tok.

Finidi George wey NFF and di Ministry of Sports for Nigeria bin unveil on 13 May, 2024 bin dey under fire.

Di 1994 Afcon Super Eagles star dey under fire sake of di results e get from di 2026 World Cup qualifying match against arch-rivals South Africa and Benin Republic.

Nigeria bin lose to Benin Republic 2-1 for dia last World Cup qualifier.

Earlier dem play 1-1 draw with South Africa for Uyo.

Nigeria currently dey 5th position out of 6 for Group C. Dem get only 3 points out of 4 matches. Dis na afta dem record 3 draws and 1 loss.

Finidi retire from playing for 2004 afta 15 years career, wey include im winning di 1994 Africa Cup of Nations as well as three league titles and di 1995 European Champions League with Ajax.

Im play wit oda ogbonge Nigerian footballers like Jay-Jay Okocha, Nwankwo Kanu, Emmanuel Amuneke, Sunday Oliseh and Daniel Amokachi among others.

Di former Real Betis man bin also play for Nigerian clubs like Calabar Rovers, Iwuanyanwu Nationale and Sharks of Port Harcourt before im move go Netherlands for 1993.

Bifor di Nigeria Football Federation appoint am, Finidi na assistant coach to former Super Eagle Coach Jose Peseiro, wia e spend 20 months wit di Portuguese tactician.

Finidi na part of di technical crew wey win 2023 Afcon silver for Cote d'Ivoire early dis year.

Finidi George na former Head Coach of Nigeria toplflight league side Enyimba International Football club.

E lead Enyimba to win di domestic league title for Nigeria. E bin lead di Super eagles to di final of di 2023 Africa Cup of Nations for Ivory Coast.

Im only task na to qualify Nigeria Super Eagles for di 2026 World Cup but im give up bifor di qualifiers end.