Euro 2024: Who go be highest goal scorer for dis year tournament?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di iconic Henri Delaunay Trophy na im go be di ultimate prize for di 2024 European Championship, but individual players also get di chance to finish top scorer and take home di Golden Boot.
Stars wey bin don win di Euro Golden Boot include: Gerd Muller, Marco van Basten, Alan Shearer and Fernando Torres, among odas.
So who e go be dis time? here na some of di contenders...
Romelu Lukaku (Belgium)

Wia dis foto come from, Getty Images
Romelu Lukaku go dey di contention afta e score 14 goals to break di scoring record for a single European Championship qualifying campaign.
Di 31-year-old na Belgium all-time top scorer with 83 goals in 114 appearances and dis Euros tournament go be di sixth major tournament e go play for di kontri.
For di 2018 World Cup, Lukaku na di third highest scorer wit four goals in seven matches.
Cody Gakpo (Netherlands)

Wia dis foto come from, Getty Images
Cody Gakpo fit be di main contender for di Golden Boot for im country, the Netherlands.
Di Liverpool forward be di top scorer for di Orange Boys during di 2022 World Cup, as e score one goal each for all dia three group matches.
End of Di one wey oda users dey read well well
So far, di 25-year-old don score nine goals in 23 international appearances.
Gianluca Scamacca (Italy)

Wia dis foto come from, Getty Images
Fans wey dey watch di Premier League regularly go remember Gianluca Scamacca wen e play for West Ham for di 2022-23 season, wia e manage to score only three league goals.
But di 25-year-old striker rediscover im best form afta e return to Atalanta, scoring 19 times for all competitions to help di Italian side win di Europa League.
E score im first goal for Italy for dia qualifying match defeat by England for Wembley stadium for October.
Robert Lewandowski (Poland)

Wia dis foto come from, Getty Images
Robert Lewandowski's Poland bin break di hearts of Wales pipo wen dem comot di kontri thru penalty shootout for dia play-off match to become one of di final teams wey qualify for Euros 2024.
Di 35-year-old former Bayern Munich man sabi wia di net dey. Na im be di all-time top scorer for Poland with 82 goals for 148 appearances, and e don score more dan 600 goals for club and kontri for 19 years wey e don play football.
Lewandoski also score three goals for three matches for Euro 2020 and dis year tournament go be im sixth major international tournament.
Cristiano Ronaldo (Portugal)

Wia dis foto come from, Getty Images
Ororo CR7 na player wey no need introduction. Even at di age of 39 superstar Cristiano Ronaldo neva dey show sign say e don dey slow down.
Na im be di highest goal scorer for international football in di world wit 128 goals for Portugal, and e also be di record appearance maker wit 206 caps.
Dis summer na im 12th international tournament and e go get di opportunity to win back-to-back Golden Boots, afta e also win am for Euro 2020 wit five goals.
Harry Kane (England)

Wia dis foto come from, Getty Images
Again, England all-time top scorer Harry Kane go be di major hope of ending di kontri 58 years wait for international football glory.
Di Three Lions captain dey enter di tournament afta e don get good first season for Bayern Munich wia e score 45 goals for 45 matches.
But dat one no mean much bicos Kane still dey wait for im first career trophy as Bayern end di season witout trophy.
Kylian Mbappe (France)

Wia dis foto come from, Getty Images
France striker Kylian Mbappe na di favourite to be top scorer for Euro 2024.
Di 25-year-old don score 46 goals for just 77 appearances for Les Bleus, who dey hope to lift di trophy for di third time afta dem win am in 1984 and 2000.
Mbappe win di Golden Boot for di 2022 World Cup wit eight goals - including a hat-trick for dat epic final defeat by Argentina.
Rasmus Hojlund (Denmark)

Wia dis foto come from, Getty Images
Rasmus Hojlund na rising star for Danish football and e appear very relaxed for di international stage.
Di 21-year-old score hat-trick for im first match for Denmark in a European qualifier against Finland in March 2023. E end di campaign as dia top scorer wit seven goals in eight appearances.
Manchester United bin pay £72m to buy Hojlund from Atalanta last summer and despite an up-and-down season, e manage to score 16 goals for 43 games for all competitions as di Red Devils win di FA Cup.
Scott McTominay (Scotland)

Wia dis foto come from, Getty Images
Scott McTominay na di talisman for Scotland during dia qualifying campaign as dem reach dia second successive European Championship.
Di 27-year-old finish as im kontri top scorer for qualifying wit seven goals. Na only Lukaku, Kane and Ronaldo score more.
Like im club-mate Rasmus Hojlund, McTominay dey enta Germany in veri good mood afta im epp Manchester United beat rivals Manchester City to carry di FA Cup.
Aleksandar Mitrovic (Serbia)

Wia dis foto come from, Getty Images
Aleksandar Mitrovic na key presence for Serbia as dem dey prepare for dia first European Championship as an independent nation.
Di 29-year-old na di all-time top scorer for Serbia wit 57 goals for 89 appearances, and e top dia scoring charts for di qualifying wit five goals.
Mitrovic get veri good season afta join Al Hilal of Saudi Arabia from Fulham for August last year.
E score 39 goals for inside 42 matches for all competitions as im club win di Saudi Pro League title.
Zeki Amdouni (Switzerland)

Wia dis foto come from, Getty Images
Zeki Amdouni na one of di breakout stars for di European qualifying as e score six goals for five appearances to epp Switzerland qualify for dia sixth successive major tournament.
But for club level, Amdouni score only six goals for 36 games as im club Burnley enta relegation.
Alvaro Morata (Spain)

Wia dis foto come from, Getty Images
Morata go lead di attack and also captain Spain as dem look to lift di European trophy for di third time.
Di experienced Atletico Madrid forward bin spend three years for Chelsea between 2017 and 2020, and e don score 34 goals for 74 appearances for Spain.
No oda player for di Spain squad don score up to 10 goals yet.
Niclas Fullkrug (Germany)

Wia dis foto come from, Getty Images
Niclas Fullkrug start im international career late, at 29 years, but e go certainly make di most of di opportunity.
Di Borussia Dortmund striker, now 31, don score 11 goals for 15 international appearances and e dey set to carry di German attack for head for dis tournament wey be say na dem dey host.
Fulkrag bin score 15 goals for Dortmund last season to help dem reach di Champions League final, where dem lose 2-0 to Real Madrid.

Wia dis foto come from, BBC Sport










