Groups, full fixtures and favourites to win Euro 2024

Wia dis foto come from, Getty Images
Di biggest football competition for European kontris - Euro 2024 - bin start for Munich, Germany.
Dem don play group stages of di match and quarter-final dey start on Thursday, 5 July.
BBC don provide all di key details for dis ogbonge tournament and di previous meetings for di group stage.
Wen di tournament bin start?
Na Germany dey host Euro 2024 edition and e officially begin on Friday, 14 June 2024 for di Allianz Arena, di home of Bayern Munich.
Scotland bin face di hosts dat 14 June for di first match of di tournament.
Di group stages bin see two to four games evri day until 26 June and di round of 16 bin start on 29 June.
Di tournament go end on Sunday, 14 July for di Olympiastadion for Berlin.
Dis go be di first time wey Germany dey host di tournament since dia reunification, di 1988 edition bin hold for West Germany.
End of Di one wey oda users dey read well well
Euro 2024 Fixtures
Group Stage
14 June
- Group A: Germany vs Scotland (Munich Football Arena, Munich, 8pm WAT)
15 June
- Group A: Hungary vs Switzerland (Cologne Stadium, Cologne, 2pm WAT)
- Group B: Spain vs Croatia (Olympiastadion, Berlin, 5pm WAT)
- Group B: Italy vs Albania (BVB Stadion, Dortmund, 8pm WAT)
16 June
- Group D: Poland vs Netherlands (Volksparkstadion, Hamburg, 2pm WAT)
- Group C: Slovenia vs Denmark (Stuttgart Arena, Stuttgart, 5pm WAT)
- Group C: Serbia vs England (Arena AufSchalke, Gelsenkirchen, 8pm WAT)
17 June
- Group E: Romania vs Ukraine (Munich Football Arena, Munich, 2pm WAT)
- Group E: Belgium vs Slovakia (Frankfurt Arena, Frankfurt, 5pm WAT)
- Group D: Austria vs France (Düsseldorf Arena, Düsseldorf, 8pm WAT)
18 June
- Group F: Turkey vs Georgia (BVB Stadion, Dortmund, 5pm WAT)
- Group F: Portugal vs Czech Republic (Leipzig Stadium, Leipzig, 8pm WAT)
19 June
- Group B: Croatia vs Albania (Volksparkstadion, Hamburg, 2pm WAT)
- Group A: Germany vs Hungary (Stuttgart Arena, Stuttgart, 5pm WAT)
- Group A: Scotland vs Switzerland (Cologne Stadium, Cologne, 8pm WAT)
20 June
- Group C: Slovenia vs Serbia (Munich Football Arena, Munich, 2pm WAT)
- Group C: Denmark vs England (Frankfurt Arena, Frankfurt, 5pm WAT)
- Group B: Spain vs Italy (Arena AufSchalke, Gelsenkirchen, 8pm WAT)
21 June
- Group E: Slovakia vs Ukraine (Dusseldorf Arena, Dusseldorf, 2pm WAT)
- Group D: Poland vs Austria (Olympiastadion, Berlin, 5pm WAT)
- Group D: Netherlands vs France (Leipzig Stadium, Leipzig, 8pm WAT)
22 June
- Group F: Georgia vs Czech Republic (Volksparkstadion, Hamburg, 2pm WAT)
- Group F: Turkey vs Portugal (BVB Stadion, Dortmund, 5pm WAT)
- Group E: Belgium vs Romania (Cologne Stadium, Cologne, 8pm WAT)
23 June
- Group A: Switzerland vs Germany (Frankfurt Arena, Frankfurt, 8pm WAT)
- Group A: Scotland vs Hungary (Stuttgart Arena, Stuttgart, 8pm WAT)
24 June
- Group B: Croatia vs Italy (Leipzig Stadium, Leipzig, 8pm WAT)
- Group B: Albania vs Spain (Dusseldorf Arena, Dusseldorf, 8pm WAT)
25 June
- Group D: Netherlands vs Austria (Olympiastadion, Berlin, 5pm WAT)
- Group D: France vs Poland (BVB Stadion, Dortmund, 5pm WAT)
- Group C: England vs Slovenia (Cologne Stadium, Cologne, 8pm WAT)
- Group C: Denmark vs Serbia (Munich Football Arena, Munich, 8pm WAT)
26 June
- Group E: Slovakia vs Romania (Frankfurt Arena, Frankfurt, 5pm WAT)
- Group E: Ukraine vs Belgium (Stuttgart Arena, Stuttgart, 5pm WAT)
- Group F: Czech Republic vs Turkey (Volksparkstadion, Hamburg, 8pm WAT)
- Group F: Georgia vs Portugal (Arena AufSchalke, Gelsenkirchen, 8pm WAT)
Rest days na 27 and 28 June
Round of 16
29 June
- Switzerland 2 vs 0 Italy (Olympiastadion, Berlin, 5pm WAT)
- Germany 2 vs 0 Denmark (BVB Stadion, Dortmund, 8pm WAT)
30 June
- England 2 vs 1 Slovakia (Arena AufSchalke, Gelsenkirchen, 5pm WAT)
- Spain 4 vs 1 Georgia (Cologne Stadium, Cologne, 8pm WAT)
1 July
- France 1 vs 0 Belgium (Dusseldorf Arena, Dusseldorf, 5pm WAT)
- Portugal 0 vs 0 Slovenia- Portugal win on penalty) (Frankfurt Arena, Frankfurt, 8pm WAT)
2 July
- Romania 0 vs 3 Netherlands (Munich Football Arena, Munich, 5pm WAT)
- Austria 1 vs 2 Turkiye (Leipzig Stadium, Leipzig, 8pm WAT)
Rest days na 3 and 4 July
Quarterfinals
5 July
- Spain vs Germany (Stuttgart Arena, Stuttgart, 5pm WAT)
- Portugal vs France (Volksparkstadion, Hamburg, 8pm WAT)
6 July
- England vs Switzerland (Dusseldorf Arena, Dusseldorf, 5pm WAT)
- Netherlands vs Turkiye (Olympiastadion, Berlin, 8pm WAT)
Rest days na 7 and 8 July
Semifinals
9 July
- Semifinal 1 (Munich Football Arena, Munich, 8pm wat)
10 July
- Semifinal 2 (BVB Stadion, Dortmund, 8pm wat)
Rest days na 11, 12 and 13 July
Final
14 July
- Final (Olympiastadion, Berlin, 8pm wat)
Who be di favourites?
England na di favourite, according to British bookmakers, wit odds of 3/1.
France na second with 4/1 and di hosts Germany na third wit 5/1.
Georgia, Albania, Slovenia and Slovakia dey less likely to win, dia odds na from 200/1 to 900/1.
How to watch Euro 2024?
All di games for Euro 2024 football tournament go dey live for Nigeria for SuperSports.
Which teams dey form?
Coming into di tournament, six teams dey unbeaten during dia qualifiers - dem be France, England, Portugal, Belgium, Romania and Hungary.
Portugal na di only side wey win all dia match, and dem score 36 goals for di qualifiers and concede only two.
Spain and Scotland lose only one match, while Turkey and Austria also qualify wit impressive records too.
Even though say Portugal win all dia qualifying matches, no be dem get di top goal scorer across dis games. Di top goal scorer na Inter Milan striker Romelu Lukaku, im score 14 goals in eight matches for Belgium.
Stadiums wey go host di games?
Di two stadium wey we go see throughout di tournament, na Allianz Arena and Olympiastadion but di host cities na 10 in total, including Cologne and Dortmund.
Signal Iduna Park, home of Borussia Dortmund 'yellow wall', go host matches for Groups B, D and F, E also dey selected as one of di venues for di last 16 and di semi-finals.
See di full list of venues for di tournament:
- Berlin: Olympiastadion (70,000 capacity)
- Cologne: Cologne Stadium (47,000),
- Dortmund: BVB Stadion Dortmund (66,000)
- Dusseldorf: Dusseldorf Arena (47,000)
- Frankfurt: Frankfurt Arena (48,000)
- Gelsenkirchen: Arena AufSchalke (50,000)
- Hamburg: Volksparkstadion Hamburg (50,000)
- Leipzig: Leipzig Stadium (42,000)
- Munich: Munich Football Arena (67,000)
- Stuttgart: Stuttgart Arena (54,000)
Which miss di tournament?
Manchester City forward Erling Haaland and Arsenal midfielder Martin Odegaard no play for di competition dis summer as Norway fail to qualify.
Dem bin dey di same group as Spain and Scotland, but dem no get enough points to gain automatic spot and also dem bin no fit qualify through di play-offs either.
Sweden na anoda kontri wey no take part for Germany, dem fail to qualify for di first time since 1996.













