How di burial of Pope Benedict XVI go happun?

Pope Benedict XVI

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Benedict XVI become di first Pope in 600 years to resign for 2013

Tens of thousands of pipo dey expected to pay dia respects give di former Pope Benedict XVI wen im lying in state start later today.

E die for New Year Eve at di age of 95, almost ten years afta e step down sake of say im dey sick.

Pope Francis go lead di Thursday burial, and e go be di first time wey successor go bury a Pope.

Di Vatican say di service go dey simple, solemn and sober.

As day break for di Vatican, one queue don already form for di edge of St Peter Square.

Wetin we call dis Video, Pope Benedict XVI: Ogbonge early queue dey build for lying in state

For di very front na Father Alfredo Elnar, 30, wey come from di Philippines. E tok say im don study and admire di theological writings of di former pontiff, and im tok about emptiness since di death of di former pope.

Also for di queue na Sister Marianna Patricevic, one nun from Croatia. She tok about how grateful she bin dey for wetin di late pope don do – tok say e no get any subject wey she study for university wia dem no discuss im views.

Father Richard Kunst, wey visit from di US, say wen im pass wia dem put di Pope body, im go pray for am - but also for a miracle to help a friend at home wey dey die of cancer.

Benedict XVI become di first Pope in 600 years to resign for 2013 sake of im health.

Im bodi go dey on display for three days for open casket for St Peter Basilica, wia pipo go fit pay respects till 7pm evri evening.

Di burial go hold for St Peter's Square, before dem lay di Pope Emeritus to rest for di burial ground under di Basilica.

Di Vatican release foto of di bodi on Sunday, as dem wear am red papal mourning robes and gold trimmed mitre.

Pope Benedict XVI

Wia dis foto come from, Reuters

Tributes don dey come from around di world, and di burial dey expected to draw crowds of thousands of pipo.

Di last papal funeral, wey be for Pope John Paul II for 2005, na one of di largest Christian gathering for history, as e carry about four million pipo enta Rome.

E neva clear how dem wan run di service, sake of say plenti of di traditions for serving Pope no necessary, most especially election for im successor.

Vatican tok-tok pesin Matteo Bruni tok say, Benedict bin ask for simple burial.

Dem neva release guest list, but Vatican don tok say dem go include delegations from Italy and Benedict native kontri of Germany.

Pope Francis pay im own tribute to im "dearest" predecessor afta im death.

American president Joe Biden hail di former Pope "lifetime devotion to di church" while Italian Prime Minister Giorgia Meloni hail am as "ogbonge man wey history no go forget".

For Brazil, we be di largest Catholic nation for world, incoming President Luiz Inácio Lula da Silva say im wish "comfort to di faithful and admirers of di Holy Father".

Pope Benedict na controversial pesin as some don criticize am say im no handle accuse of clerical sexual abuse well.