Pastor Enoch Adeboye, Oyedepo, Olukoya, Iginla prophecies for 2023

Nigeria pastors

Wia dis foto come from, FACEBOOK @PASTOR ADEBOYE, OYEDEPO, OLUKOYA

Prophecies about weather, politics, 2023 Nigeria general elections, judgement on di wicked na some of di prophecies some religious leaders don release concerning 2023.

Evri year, religious leaders for Africa, especially Nigeria dey most often tell dia kontri pipo dia members and kontri pipo wetin God don tell dem concerning di new year.

For 2023, religious leaders give prophecy concerning di year and for some na prophetic declarations.

Dis na some of dem:

Joshua Iginla

Joshua Iginla

Wia dis foto come from, Joshua Iginla/FACEBOOK

Prophet Joshua Iginla, di founder of Champions Royal Assembly for Abuja, Nigeria capital no dey new wen e come to mata of new year prophecies.

E don dey drop New Year prophecies back to back for sometimes now and dis year no dey different.

For year 2023, Joshua Iginla give prophecy concerning di general elections wey go hold for February for Nigeria, politicians, Africa and for di international community.

2023 general election

Di prophet say make parties wey tink say dem strong, stand well-well and no dey too overconfident as plenty surprises go dey.

Politicians wey hold Lagos and Rivers state go continue to hold am.

E say 2023 na year of mystery. “Pipo wey you dey embrace fit be pipo wey go betray you and pipo wey go strengthen you fit be pipo you dey despise.”

E say Nigeria go experience battles, tensions afta di elections. He say make Nigerians pray say make di outcome of di election go down well wit di players and dos wey no like di outcome make dem address am through legitimate means.

“Di new goment wey go enta go take drastic measures to create tension but e go lead to sustainable growth wey go shock us.” e tok.

Politicians and odas

Peter Obi

Prophet Iginla say di Labour Presidential Candidate Peter Obi must work hard on im security before and during di elections.

E say Peter Obi na man wit mysterious destiny – e say mighty betrayals go come from quarters wey e least expect.

Bola Ahmed Tinubu

Concerning di All Progressives Congress presidential candidate, say “Tinubu go suffer sensitive betrayal, tough ones but e no go change anytin, over confidence dey dangerous.”

Govnor Nyesom Wike

For Rivers state Govnor, Nyesom Wike, di prophet say Wike political destiny neva dey over.

“E go play major political role for di destiny of dis kontri. Something dey ahead but make e pray and watch im health and dey careful make e no become sacrificial lamb through poison.”

Godwin Emefiele

E say make di Central Bank Govnor, Godwin Emefiele pray very well as hard time dey come.

Mazi Nnamdi Kanu

Prophet Iginla also give prophecy about di leader of di Proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB). E say goment go release Nnamdi Kanu but e need pray for im health. He say im gatz pray more afta dem release am for strength. “Nnamdi Kanu gatz fight to stay alive, make e tink about im health, e dey important.”

G5 Governors

Concerning di G5 govnors wey dey made up of Rivers state Govnor, Nyesom Wike, Oyo state govnor, Seyi Makinde, Benue state govnor, Samuel Ortom, Akwa Ibom State Governor, Udom Emmanuel and Ifeanyi Ugwuanyi of Enugu State, di prophet say make dem pray to pull through for dia bid to serve dis kontri. especially one of dem.

E add say anybody wey dem give dia support no undermine am, as e go make difference.

Pastors

He say scandals go rock pastors – “Some go be self-inflicted, some go be manipulation of enemy.”

African and International community

For African kontris, e call for prayers against attack on dia democracies make e no dey truncated.

E say im see military intervention for most African kontries between now and 2028.

For South Africa: Di president Cyril Ramaphosa go narrowly win di 2024 election.

E say leader of di Economic Freedom Fighters Julius Malema go one day become president because e dey im destiny.

International Community

E say anoda pandemic dey come. E advise make Russia president Vladmir Putin pray concerning im health. “I see strong attack dey come so dat e no go become vegetable.”

Relative peace go dey for Russia/Ukraine

Year of relative peace - Pst. Enoch Adejare Adejare

Pastor E.A. ADEBOYE

Wia dis foto come from, PASTOR ADEBOYE/TWITTER

Di General Overseer of di Redeemed Christian Church Of God wey pipo sabi as Daddy G.O give prophecy about di world and individuals.

E say for 2023, di world go dey relatively peaceful. Weather go change small but for God pipo, di weather go dey nice wherever dem go.

For individuals and di general public, Daddy GO say troublers no go fit make trouble again and some pipo wey dia glory don lost go get am back.

Redeemed Christian Church of God na arguably one of di largest churches for Nigeria.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Daniel Olukoya release 30 point prophecies for 2023

Daniel Olukoya

Wia dis foto come from, FACEBOOK @DANIEL OLUKOYA

Dr Daniel Olukoya na di General Overseer of di popular Mountain of Fire and Miracle Ministries.

Apart from being a priest, Olukoya na also scholar for di field of 'Biotechnology'. E don teach for various universities for Nigeria.

He release 30 prophecies for 2023, some na for individuals and some na for di kontri.

Dis na some of dem:

  • 2023 go be year of recovery and turn around for many pipo.
  • Na year wen God go break im silence to deal wit evil and wickedness.
  • Na year wen God go dismantle mighty men wey stand in di way of God.
  • Year of judgement for pipo wey turn di altars of prayers to dens of thieves.
  • Year of regret of judgement for ritual killers and dia activities go backfire.
  • Year of tragedy for youth wey reduce to exhibit sexual control.
  • A year of di disgrace of fake, hypocritical and powerless religions.
  • A year of correction, confrontation and change for those wey wan move forward. 

Giants go rise - Bishop Oyedepo

Bishop Oyedepo

Wia dis foto come from, FACEBOOK @DAVID OYEDEPO

Bishop David Oyedepo of Living Faith Church also don join tok im prophecies for di year 2023.

Oyedepo say for dis year plenty solution providers go increase.

He add say “Army of giants, di kind wey di world never see before go rise from our midst, notwithstanding di darkness wey dey hover around di world.”

E also release wetin im title, prophetic declarations wey dey dey more about individuals for im twitter handle. 

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Meanwhile, Ghana Police for Ghana don warn religious leaders say for dia traditional New Year prophesies make dem no tok di one wey go cause fear, anxiety or death.

Di police tok for statement say di right of freedom of worship no suppose affect di rights of odas.

Di police order bin come into full force last year afta di public get plenti informate about prophesy of death and kasala, according to local tori pipo.

Also, e dey important to tok here say most times, dis prophecies by di pastors dem no dey come to pass.