Wetin we know about di attack on former Imo state govnor Ikedi Ohakim wey kill four pipo

Ikedi Ohakim

Wia dis foto come from, OTHERS

Gunmen attackd di convoy of former governor of Imo State, Ikedi Ohakim, on Monday, January 2, and kill im driver and three oda members of im team.

Di incident happun for Ori-Agu, Ehime Mbano Local Goment Area, wen di former govnor and im two pikin dem bin dey return from im hometown to Owerri, di Imo State capital.

Dem bin try block Ohakim car but di driver manage to escape from dem.

Di gunmen throw explosives for di security car wey dey guard Ohakim and kill four pipo in di process.

Wen BBC Igbo call di former govnor, e bin still dey in shock.

But one of im special assistants, Emmanuel Chukwu, confam di incident to BBC Igbo.

“Ohakim and two of im pikin dem (one male and one female) bin dey inside car wen di incident happun.

“Dem bin dey return from dia visit and reach one place called Oriagu between Isiala Mbano and Ehime Mbano wen di gunmen attack dia cars,” Chukwu tok.

Chukwu also tok say dem no sabi di exact perpetrators of di attack and dem dey sad say four policemen don die sake of di incident.

Wen BBC Pidgin contact di Imo State Police Command tok-tok pesin, im tok say im dey meeting. But we still dey monitor dis tori.

Who be Ikedi Ohakim?

Ikedi Ohakim na former govnor of Imo State wey lead di state between 2007 and 2001.

Ohakim only lead Imo State for one term of four years.

Di former govnor come from Okohia for Isiala Mbano Local Goment Area of Imo State.

Ohakim take ova from Achike Udenwa and for 2007 Rochas Okorocha succeed am as govnor of Imo State.

Di former govnor dey married to Barrister Chioma Ohakim. Dem get five pikin dem.

Oda gunmen attack on convoy wey make headlines

Security kasala na one of di issues wey Nigeria dey face as a kontri and many pipo don lose dia lives to attacks by gunmen in recent times.

Attack on politicians and VIPs dia convoy too na sometin wey don make headline too.

One recent one na dat of Senator Ifeanyi Ubah wey shele for September 2022.

Five pipo bin die afta gunmen attack di convoy of Senator Ubah for Anambra state.

Di attack happun for Nkwo Enugwu-Ukwu, Njikoka local goment area of di state.

Di senator aide, Kamen Ogbonna confam di incident to BBC Pidgin.

Viral video for social media show about three vehicles wit deadi bodi inside dem.

Ogbonna confam say di pipo wey die for di attack include di senator aides and police officers. But di senator wey bin dey inside bullet proof vehicle manage escape.

Popular Nigerian pastor Apostle Suleman also escape death for October 2022 wen gunmen attack im convoy for Auchi, Edo State.

Suleman family bin dey di convoy wen di attack happun but dem manage to escape while seven pipo including police officers die.

"My car dey attacked, dem open fire on my car and continue to spray bullets, my wife and kids dey for di escort car for di front. Dem kill di police, dem kill di oda pipo for di oda escort car and di buses wey dey wit us. Dem kill seven pipo wey dey move wit di convoy,” di pastor bin tok.