Police arrest Hollywood director Rob Reiner son for murder after im parents death

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Regan Morris
- Reporting from, Los Angeles
- Author, Yang Tian
- Read am in 4 mins
Police don arrest Nick Reiner, di son of Rob Reiner, and e dey for custody according to reports.
Dem book Nick Reiner for "murder" after authorities find di dead bodi of im parents Rob and Michele Reiner for dia home.
Police say im be suspect for di case and dem hold am on a $4 million bail.
Dem carry di 32-year-old wey dem arrest on Sunday, go jail on Monday.
Di LASD Inmate Information Center say dem dey hold di 32-year-old for a felony-level crime. E say dem arrest am around 21:15 local time on Sunday, and book am around 05:04 on Monday.
Dis na after dem find di legendary Hollywood actor and filmmaker Rob Reiner and im wife Michele dead for dia Los Angeles home, according to BBC news partner CBS.
Police dey torchlight di incident as a case of homicide afta police and firefighters get call to one house for di Brentwood neighbourhood on Sunday evening.
As dem dey reach, authorities see one 78-year-old man and 68-year-old woman – say two of dem don die for dia house.

Wia dis foto come from, Getty Images
Reiner na ogbonge Hollywood filmmaker wey im feems include classics like The Princess Bride, When Harry Met Sally, and This is Spinal Tap.
Tok-tok pesin for di Los Angeles Fire Department tell di BBC say dem bin get call around 15:38 local time (23:38 GMT) for medical aid to one house Chadbourne Avenue.
Brentwood na rich pipo area for LA and home to many celebrities.
Robbery homicide detectives from di LA police department also respond to di home and don open homicide investigation.
Once inside di residence, police say dem see two pipo wey don die, but dem provide further details on wetin cause dia death.
For press conference on Sunday night, police say dem go conduct conduct full crime scene investigation for di residence in di coming days.
Police no give details about any injuries di two get and say di cause of death go dey determined by di LA coroner office.
California Governor Gavin Newsom bin release statement for social media wey confam di death of Reiner and im wife.
Newsom say im dey "heartbroken" by di death and call Reiner a "big-hearted genius behind so many of di classic stories we love".
LA mayor Karen Bass call Reiner death a "big loss for our city and kontri", and pay tribute to di couple charity work for childhood development and LGBTQ+ advocacy.
Reiner, wey be TV star in di 1970s play Meathead for di groundbreaking comedy All in The Family, E bin marry actress Penny Marshall from 1971 to 1981. Im na di adoptive father to Marshall daughter, actress Tracy Reiner.
E later marry Michele Reiner, actress and photographer, for 1989. Di couple get three children togeda, Jake, Nick and Romy.
Who be Nick Reiner?
Nick Reiner, 32, na di middle son of di family. Rob Reiner and Michele Singer share three children togeda.
E don work as a screenwriter, e co-write di screenplay for di 2016 film "Being Charlie", wey im father direct.
Di film, about one drug-addicted teenager, bin dey somehow based on im own addiction struggles, e bin tell People at di time of di film release.









