Eyewitness capture di moment one man tackle and disarm Bondi Beach shooter for Australia
Eyewitness capture di moment one man tackle and disarm Bondi Beach shooter for Australia
Twelve pipo don die and at least 11 odas, including two police officers, wound for one shooting for Bondi Beach on Sunday for Australia.
Footage wey one eyewitness bin capture show one man as e dey struggle wit one of di alleged gunmen, bifor im wrestle di weapon from am.
For press conference, di New South Wales Police Premier Chris Minns tok say dem bin kill one of di gunmen and anoda one dey dia custody.




