Main suspect for di murder of South African university student Olorato Mongale die for police shootout

Wia dis foto come from, South Africa Police/ X
One suspect wey dey wanted for di murder of one South African university student don die for police shootout.
Di man bin dey linked to di killing of Olorato Mongale wey dem find her deadibodi for Johannesburg on Sunday. Dis na just two hours afta dem report am say she don lost unto say she go for date.
For early mor-mor on Friday 30 May, na so police find di main suspect dey hide inside residential complex for di coastal town of Amanzimtoti. Dis na wetin police tok-tok pesin Brig Athlenda Mathe
Mathe add say di suspect wey police neva release im name come outside, bin shoot gun for police, na so police decide to do dia own back and kill am.
Regional police commissioner Nhlanhla Mkhwanazi tok say wen di suspect die, dem find 28 ID Cards and one dozen hand phone for im hand.
Di 30-year-old South African university graduate student Olorato Mongale bin meet her death wen she bin go on a date wit some men wey pick her from her residence.
Di South African police bin first declare Mongale missing for 27 May, 2025, wey be two days afta she follow di men go on a date but she no return.
Dem later find her deadi bodi for wia dem dump her for open field afta dem kill her.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to di South African police, dem don declare two suspects wanted in connection wit di murder of Mongale.
Mogale dey study for a postgraduate degree for Witwatersrand University.
She bin call her friend say one man wey she meet for Johannesburg wey identify im name as John bin invite her to a date, and she dey excited.
How dem murder Olorato Mongale and wetin police find

Wia dis foto come from, X/South Africa police
According to di police for South Africa, di suspects bin pick Mongale on a date from her residential complex as dem drive inside a white VW Polo.
Na from her house for Johannesburg, Mongale bin follow dem at around 15:00 pm on Sunday, 25 May 2025.
Dem drive wit di victim for di town of Alexandra, proceed to Kew and between Alexandra and Lombardy West for Johannesburg, according to di police.
"Dis man allegedly murder Olorato and dump her body."
"During investigations, e show say di VW Polo get fake registration number plates."
Dis police say dia National Crime Intelligence Unit don find di vehicle wey di men use commit di crime and dem don seize am. Dem reveal say na for panel beater side dem find di suspects car for Durban.
"Di investigation first lead di team to a lodge for Kew, Johannesburg wia two suspects bin book a room."
"Further intelligence lead dem to KwaMashu for Durban to di home of one of di suspects. Dem later find di suspects vehicle for panel beater workshop."
South Africa police add say afta dia analysis, dem find traces of blood for inside di vehicle.
Although di police bin arrest di elderly man wey dem believe say e get di car, but di two suspects bin run.
South Africa declare suspects wanted
Afta di death of Mongale, South African police begin dey hunt di suspects wey get involvement for di murder of di university student.
Na Sunday dem see Mongale last wit di men, and report say she bin meet dem a few days earlier for one shopping centre.
Late on Wednesday, South Africa police name three suspects wey dem believe fit dey involve for her death.
"We don break back of a syndicate wey dey target women, especially young women, for malls... for kidnapping and robbery," di police tok-tok pesin Brig Athlenda Mathe tok.
Di CCTV footage wey police get bin show as she comot from di location for Kew, Johannesburg, and she waka towards one white VW Polo, wit fake licence plates.
South Africa police bin name Fezile Ngubane and Philangenkosi Sibongokuhle Makhanya as suspects.
Meanwhile, di police say suspects don use di same vehicle bifor wia dem kidnap and rob one woman for KwaZulu-Natal.

Wia dis foto come from, South Africa police / X
Olorato Mongale family and South Africa authority react
Di BBC report say Mongale family tok tok pesin Criselda Kananda, lament say her bodi dey "brutally violated".
Family and friends don describe her as outspoken, bubbly woman wey "live wit purpose and love", local media report.
Speaking on behalf of di South African Police Service, di Minister of Police, Mr Senzo Mchunu say di terrible horrific act shock di nation and dey vex dem.
Di minister also condemn di 'gruesome and inhumane killing of Mongale and say make men "stop to dey kill women."
"Di seizure of di vehicle allegedly use for di crime and di investigation of di owner, wey currently dey under police custody, na crucial step toward justice."
Mongale death don cause serious gbege and debate about di levels of violence wey women for South Africa dey face.
Dem kill about 137 and rape more dan 1,000 women for South Africa between January and March, according to di latest crime statistics.














