Afcon 2025 fixtures, results, scores, and group standings

    • Author, Victor Ezeama
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 3 mins

Di 2025 Africa Cup of Nations (Afcon) don dey take shape as we don dey sabi di kontris wey go enta di quarter-finals.

Di Round of 16 go conclude on Tuesday as Algeria go face DR Congo while defending champions Ivory Coast go jam Burkina Faso.

Winners fron dis matches go complete di last eight wey go stand a chance to play for demi-finals slot.

So far, di kontris wey don qualify include:

Dis na afta dem top Group C wit nine points.

Morocco: Di Atlas Lions and hosts beat Tanzania 1-0 to qualify for di last eight. Dem bin top Group A wit seven points to progress to di knock-out stage.

Senegal: Senegal sama Sudan 3-1. Di Teranga Lions no come play as dem bin top D wit seven points, same points wit DR Congo.

Mali : Mali beat Tunisia 3-2 on penalties afta dem play 1-1 draw. Mali finish second for Group A wit three points.

Egypt: Di Pharaohs of Egypt wire Benin Republic 3-1 for di match wey enta extra time. Egypt finish wit seven points for Group B.

Cameroon: Di Indomitable Lions no play wit Bafana Bafana of South Africa at all,

dem jam rock as Cameroon end dia over 30 years dream to win Afcon trophy. Di last time South Africa win Afcon trophy na for 1996.

Cameroon beat South Africa 2-1 to progress for di tournament as South Africa pack dia load go house.

Wetin to know about Afcon

Di 2025 edition bin suppose be mid-year tournament, to allow make e for no clash wit European clubs and competitions.

Di summer event suppose boost tourism and highlight wetin Morocco get to offer, before di kontri co-hosts di 2030 World Cup wit Spain and Portugal.

But dem shift am to December to make way for Fifa expanded Club World Cup, wey dey hold for summer.

Di move to a start in December rather dan January go avoid conflicts wit di Champions League and Europa League, wey go restart on 20 and 22 January respectively.

Dis go be di first time Afcon go hold for dis time of di year wit matches wey dem go play for Rabat, Casablanca, Marrakech, Agadir, Tangier and Fez.

Make you engage wit di graphic below to see di group tables and fixtures. Di match results go dey update automatically once di matches end.