Court remand Nnamdi Kanu brother, im lawyer and odas for Kuje prison after Abuja protest

One Magistrate Court for Kuje, for di Federal Capital Territory, don remand Emmanuel Kanu, younger broda of Nnamdi Kanu, for Kuje prison, togeda wit Kanu lawyer Aloy Ejimakor, and anoda human rights lawyer Kingdom Okere.
Dis na according to Nnaemeka Ejiofor, wey also be one of di lawyers for Nnamdi Kanu legal team.
Nigeria police bin confirm on Monday through tok-tok pesin Benjamin Hundeyin say dem arrest Ejimakor and Emmanuel Kanu sake of say dem disobey court order wey ban di protest wey hapun for Abuja on Monday, and also bicos dem disobey lawful order.
On Monday morning, former presidential candidate and activist Omoyele Sowore and oda protesters march to di Nigeria Federal Capital Territory to demand for di release of Nnamdi Kanu, di leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob, wey dey face treason and oda charges.
Dis na even as authorities issue warnings on Saturday base on one court order make protesters no gada any wia.
Security agencies bin take ova major roads and locations for Abuja, Nigeria Federal Capital Territory ova di planned protest.
Tori be say security forces block all di road wey lead to Aso Rock and fire teargas and arrest some protesters wey gada to demand for di release of Nnamdi Kanu.
Hundeyin bin tok say police go charge dem to court afta dia investigation.
"Dem remand dem for Kuje prison but we dey file motion to see say dem come out," Ejiofor confirm to our reporter.
For di court sheet wey our reporter see, na total of 12 pipo wey di police bin arrest and dia names na:
- Barr Aloy Ejimakor
- Prince Emmanuel Kanu
- Joshua Emmanuel
- Bishop Wilson Anyalewechi
- Barr Okere Kingdom Nnamdi
- Clinton Chinemeze
- Gabriel Joshua
- Isiaka Husseini
- Onyekachi Feridnand
- Amadi Prince
- Edison Ojisom
- Godswill Obiama
Di police claim say dem arrest di offenders "for several locations within di FCT as dem dey involve diasef for inciting disturbance and breach of public peace in disobedience to a court order".
Oda charges na: "Denying oda citizens freedom of movement, disrupting free flow of traffic while chanting war songs, and requesting for di release of Nnamdi Kanu wey dey undergo trial for di federal high court in a manner wey threaten National security."
According to di charge sheet, di offences dey contrary to sections 152, 113 and 114 of di Penal Code Law.
Ejimakor post for im X handle on Tuesday say: "I dey safe and sound but still under custody for Kuje prison. Di Magistrate refuse to listen to our submissions. E insist on remanding us till Friday and e have im way. For context: Keep in mind say dem bypass plenty Magistrate courts for town and head to dis one for Kuje."
On Monday, during di protest, our tori pesin bin tok wit Nnamdi Kanu sister, Nnenna Kanu, who narrate to us how dem find out say im broda and dia lawyer don dey arrested.
She say all of dem bin dey togeda for di protest ground, but afta di police trow teargas to scata dem, but "wen we regroup, we no fit find Fine Boy and Ejimakor again".
'Fine Boy' na di nick name wey close family members dey call Emmanuel Kanu.







