You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Venezuela Maria Corina Machado win 2025 Nobel Peace Prize
Venezuela Maria Corina Machado don win 2025 Nobel Peace Prize.
According to di announcement, Norwegian Nobel Committee decide to award di 2025 Nobel Peace Prize to Maria Corina Machado sake of her tireless work to promote democratic rights for di pipo of Venezuela.
Di committee award her sake of her struggle to achieve just and peaceful transition from dictatorship to democracy for her kontri.
"As di leader of di democracy movement for Venezuela, Maria Corina Machado na one of di most extraordinary examples of civilian courage for Latin America for recent times."
"Maria Corina Machado meet all three criteria wey dey stated for Alfred Nobel will for di selection of Peace Prize laureate. She bring her kontri opposition togeda"
Dem announce Machado as winner on Friday 10 October.
Di Nobel Peace committee say Maria Corina Machado don show say tools of democracy na also di tools of peace and she carry di hope of different future, wia di fundamental rights of citizens dey protected, and dia voices dey heard.
For 2024, di Nobel Peace committee bin award one Japanese group of pipo wey survive di atomic bombing wey dem dey call Nihon Hidankyo as di winner of di 2024 Nobel Peace Prize.
Di survivors of di 1945 bombings bin win based on di work wey dem dey do to comot nuclear weapons from di world.
For di same vein, di 2025 winner Machado don join part of di brave women and men wey di Norwegian Nobel Committee don award sake of how dem don stand for to injustice and dose wey don show actions say peace fit change di world.
Profile of María Corina Machado
María Corina Machado na di opposition leader for Venezuela. Dem bar her from contesting for last year presidential elections, wey dey widely dismissed internationally say e no dey free nor fair.
María Corina Machado don dey hide since August 2024. Di Venezuelan opposition leader disappear from di public sake of di elections for July of dat year.
Even afta dem bar her from running for di presidency, she succeed to get di opposition - and millions of Venezuelans - to follow di little-known candidate wey later replace her on di ballot, Edmundo González.
Wen di govment-controlled National Electoral Council declare Nicolás Maduro di winner, Machado no give up.
All di polls last year point say her movement go win. But, Maduro win office for third term despite election observers documenting many irregularities.
Machado hersef bin dey live for hiding pretty much eva since, except during her brief appearance wen protest bin happun ahead of Maduro inauguration for January. Dem arrest her but later free her
White House slam Nobel Committee for not awarding Peace Prize to Trump
Di White House don accuse di Nobel Committee of say dem put "politics ova peace" as dem award dia most wanted prize give one Venezuelan pro-democracy activist ova President Donald Trump.
Trump bin dey very open about im desire for di award, as e don take credit for ending several global conflicts. E dey regularly bring am up, including during im address to di UN General Assembly for September.
"Di Nobel Committee prove say dem put politics ova peace," White House communications director Steven Cheung tok afta di announcement.
"President Trump go continue to make peace deals, ending wars, and saving lives," Cheung write on X. "He get di heart of a humanitarian, and nobody go ever be am wey fit move mountains wit di sheer force of im will."
Trump don play ogbonge role in forcing a multi-stage deal for ceasefire for Gaza, wey e announce two days bifor di Nobel Peace Prize dey awarded.
Di president don also claim say im don end plenty global conflicts during im nine months in office, and for im previous term.