You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Narges Mohammadi na 2023 Nobel Peace Prize winner
Iranian Narges Mohammadi don win di 2023 Nobel Peace Prize.
Dem announce di winner of di ogbonge award for di “promotion of peace” for di Norwegian Nobel Institute for Oslo.
Di committee tok say she receive di prize for her fight against di oppression of women for Iran and her efforts for promoting human rights and freedom for all.
More dan 350 pipo and groups dey nominated but Nobel Prize no disclose dia names sake of say dem no dey announce names of nominees.
Narges Mohammadi na Iranian campaigner and deputy head of di Defenders of Human Rights Center, wey fellow Nobel laureate Shirin Ebadi found.
Mohammadi don receive several jail sentences since 2011 and she currently dey Tehran notorious Evin prison for "spreading propaganda".
Dis year dem also include am for di BBC's 100 Women - a high profile list of 100 inspiring and influential women globally.
Wen dem award am di prize, di Nobel committee tok say Mohammadi "brave struggle don come wit plenty personal cost".
End of Di one wey oda users dey read well well
"Altogether, di regime don arrest am 13 times, convict am five times and sentence am to a total of 31 years for prison," Berit Reiss-Andersen wey be di head of di Norwegian Nobel Committee for Oslo tok.
Narges Mohammadi "still dey for prison as I speak", she add.
Di prize come after one year of Iran protests
Di Nobel committee decision to award dia peace prize to Narges Mohammadi dey come after more dan a year of protests for di kontri by women.
Di protests start for September 2022 after Mahsa Amini, one 22-year-old, die for custody of Iran notorious morality police.
Di unrest rapidly spread across di kontri as di women demand for more freedom and di overthrow of di state.
Images of Iranian women wey dey set dia headscarves on fire and chanting "women, life, freedom" captivate di world.
Di authorities don brutally crack down on di protests and dem don reduce.
We hope dem go release am to receive award - Nobel
Di Norwegian Nobel Committee tok say dem hope Iran go release Narges Mohammadi from jail so she go fit attend di prize ceremony for December.
"If di Iranian authorities make di right decision, dem go release her so she go fit dey present to receive dis honour, wey we primarily hope for," Berit Reiss-Andersen wey be di head of di committee tok.
Who don win am before?
Since dem start am for 1901, di Nobel Peace Prize don dey awarded to 110 individuals and 30 organisations.
Dem share last year award between human rights activist Ales Bialiatski, di Ukrainian Center for Civil Liberties, wey dey document alleged war crimes, and Memorial, one rights group wey dem ban for Russia.
Oda past winners include Afghan campaigner Malala Yousafzai, and Abiy Ahmed, di Prime Minister of Ethiopia.
Some organisations don get di award several times. Di International Committee of di Red Cross don win am three times, and di Office of di United Nations High Commissioner for Refugees don win am two times.
Who don win di oda Nobel Prizes this year?
No be just di award for peace di Nobel committee dey present. E get six categories and dem dey widely regarded as di most prestigious awards for intellectual achievement for di world.
Dem dey confirm di winners dis week and dem don already confirm several winners.
Dem give di physics prize to Pierre Agostini, Ferenc Krausz and Anne L'Huillier. Dia research bin demonstrate a way to create extremely short pulses of light wey fit dey used to capture and study rapid processes inside atoms.
Norwegian author, playwright and poet Jon Fosse win di prize for Literature. Di Nobel committee tok say Fosse work bin focus on "anxieties, insecurities, questions of life and death".
Dem award di prize in physiology or Medicine to Katalin Kariko and Drew Weissman, wey develop di technology wey lead to di mRNA Covid vaccines, such as di ones wey Pfizer and AstraZeneca produce.
And lastly, di prize for chemistry dey awarded to three scientists for dia work in developing quantum dots. You fit find dis tiny crystals for QLED TV sets where di nanoparticles create colour.
Wetin di prize winners go get?
Dis year winner go receive prize money of 11 million Swedish Kroner, equivalent to nearly a million US dollars. Na 10% increase from last year amount.
Recipients go also get diploma and one of di Nobel Committee iconic 18-carat gold medals.
Di front of di medal shows one side profile of founder Alfred Nobel.
On di back, three men dey pictured as dem "form a fraternal bond" wit di inscription "Pro pace et fraternitate gentium," a Latin phrase wey mean "for di peace and brotherhood of men".