You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
National Council of State approve Prof Joash Amupitan as new Inec chairman
Di National Council of State for Nigeria don approve President Bola Tinubu nominee, Professor Joash Ojo Amupitan (SAN) as di new Chairman of di Independent National Electoral Commission (Inec).
Dis announcement dey come afta Professor Mahmood Yakubu step down from di position wey e occupy for ten years on Tuesday, 7 September.
Di 58-year-old Professor of Law come from Kogi State, North-central Nigeria.
Special Assistant to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, announce di informate on Thursday, 9 September.
"Council members unanimously support di nomination, plus Govnor Ahmed Usman Ododo describe Amupitan as man of integrity," di statement read.
In compliance wit di constitution, President Tinubu go now send Amupitan name go di Senate for screening, di statement add.
President Tinubu bin inform di council say Amupitan na di first pesin from Kogi, North-Central state, wey dem nominate to occupy di position and e dey apolitical.
Di former Inec Chair Yakubu bin serve from 2015 till October 2025, ten years.
Profile: Prof. Joash Amupitan
Di new Inec Professor of Law for di University of Jos come from Ayetoro Gbede, Ijumu local govment area for Kogi State.
E specialise for Company Law, Law of Evidence, Corporate Governance and Privatisation Law.
E become Senior Advocate of Nigeria for September 2014.
Dem born am for April 25, 1967.
Afta e complete im primary and secondary education, e attend Kwara State Polytechnic, Ilorin, from 1982 to 1984, and di University of Jos from 1984 to 1987.
Dem call am to di bar for 1988. E earn im LLM for Unijos 1993 and a PhD for 2007.
E do im National Youth Service for Bauchi State Publishing Corporation for Bauchi from 1988 to 1989.
Bifor dis appointment, e bin dey serve as di Deputy Vice-Chancellor (Administration) for di University of Jos, position wey e hold togeda wit anoda one wey be di Pro-Chancellor and Chairman of di Governing Council of Joseph Ayo Babalola University for Osun State.
Among di academic positions e don hold for UNIJOS na:
- Chairman of di Committee of Deans and Directors (2012-2014)
- Dean of di Faculty of Law (2008-2014)
- Head of Public Law (2006-2008)
Outside of di academics, Amupitan don serve on di board of several organizations wey include, board member of Integrated Dairies Limited, di Nigerian Institute of Advanced Legal Studies Governing Council, di Council of Legal Education, Riss Oil Limited, among odas.
Di new electoral body chairmo also na author. Oga Amupitan don author many books on law like Corporate Governance: Models and Principles (2008); Documentary Evidence in Nigeria (2008); Evidence Law: Theory and Practice in Nigeria (2013), Principles of Company Law (2013) plus Introduction to the Law of Trust in Nigeria (2014).
E dey married wit four children.
Di first assignment wey go dey bifor di new electoral chairmo go be di Anambra State Off-Cycle govnorship elections wey go hold for 8 November, 2025.