'I no dey prophesy for money' - Primate Ayodele address minister of power Bayo Adelabu N150 million claim

Wia dis foto come from, INRI Evangelical Spiritual Church/Federal Ministry of Power
E appear say small gbege dey sup between di popular Nigerian prophet and founder of INRI Evangelical Spiritual Church Lagos, Primate Elijah Ayodele, and di minister of power, Bayo Adelabu as report say both of dem dey drag one mata wey concern money.
According report, Nigeria minister of Power Adelabu don carry Primate Ayodele mata go di dormot of di Department of State Service (DSS) wit petition say e dey make prophecies wey dey spoil im reputation.
According to local media TheCable for dia exclusive report, dem say Adelabu petition di DSS wit accuse say Primate Ayodele dey blackmail am wit im prophecies.
Di minister accuse di prophet say e wan collect about 150 million naira from am for spiritual prayers so e go fit become govnor of Oyo state.
For di petition wey TheCable quote wit date 13 October, 2025, signed by Bolaji Tunji, wey be di adviser on strategic communications and media relations to di minister, e say Primate Ayodele allegedly demand money for spiritual items.
Meanwhile, Primate Ayodele through statement from im media aide, Osho Oluwatosin, say e no demand 150 million naira from di Minister.
'I no ask Adelabu to bring money'
Di media aide to di prophet say e no ask make di minister send money to am. Di prophet add say na only to buy spiritual items like trumpets na di tin wey e ask am.
"I no ask Bayo Adelabu to bring money for prayers. I tell am to ask someone from im end to go to di market and find out how much di trumpet cost, while someone follow dem from my end too."
Primate Ayodele say dem Adelabu pipo put am under pressure sake of say "dey desperate for govnorship."
Meanwhile, for di petition to di DSS, Adelabu say di reason why e reject di request from di prophet na sake of say e no believe fetish practices becos im govnorship ambition na by service to di pipo.
For Primate Ayodele side, e say e only give di figure of how much e go cost to buy di trumpets and make di minister send pesin go confam prices of di instrument.
E add say di minister fit no get di Oyo state govnorship ticket, but e go fit get am if e buy musical instruments, even though no be for im church.
"I tell am say dem fit no wan give am di govnorship ticket, but if e wan am so bad, e fit seek di mercy of God if e buy musical instruments for God, no be even for my church, but e say e no fit do am," Ayodele statement tok.
Primate Ayodele say na Adelabu bin tok say "e fit give anytin to become di next govnor of Oyo state" and di only tin wey e tell am make e give na for im own sake.
Meanwhile, Adelabu petition tok say Primate Ayodele ask am to bring APC flags for prayers and also ask for saxophones/trumpets.
But Adelabu say e no yield to di request of di prophet, and na dat one make di prophet tok say im no go fit become di govnor of Oyo state.
Di minister come ask make di DSS investigate Primate Ayodele and ask am to apologise and withdraw im "false prophecies".
Meanwhile, Primate Ayodele say e don dey tok about Adelabu for years say e no go become Oyo state govnor, and na di minister send pipo to come meet am for spiritual help.
"I no dey make prophecies to make money. I dey blessed already, and my prophecies afta our discussion about im ambition no be becos say e no buy di musical instrument. It can never be," statement from Primate Ayodele tok.
Adelabu na former govnorship candidate, e don contest for Oyo govnorship position bifor but e no enta, and now e dey eye 2027 again.










