You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Three tins wey go wrong for di 2025 UTME Jamb exam
Since di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) confam say true-true errors bin happun for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), pipo still dey ask wetin really happun?
Candidates bin write di examination across di kontri between Friday 25 April and end on 5 May.
Wen Jamb release breakdown of how di 2025 results be, di examination body say dem record di lowest performance in di history of di Computer Based Test [CBT].
According to Jamb, na about 1,955,069 candidates bin write di 2025 UTME examination. Out of dat candidates, ova 50 per cent score below 200.
Na only 4,756 candidates score 320 and above, while 12,414 candidates score 300 and above, according to Jamb analysis.
"As part of di results, 40,247 underage candidates dey permitted to demonstrate dia exceptional abilities.
Howeva, only 467 of dis candidates (1.16%) bin achieve scores wey meet di point for exceptional ability as defined for di UTME, wit dia performance for di subsequent three stages still pending," Jamb tok.
Dis results bin no sweet di belle of candidates, dia parents and guardians, plus oda pipo wey dey concerned about education for Nigeria.
Dem begin drag Jamb for social media, sotay pipo begin ask kwesions about why students dey underperform wey force di body to do dia review sharp-sharp.
Jamb make promise say if dem chook eye for dis complaints and find out say errors bin dey, di candidates wey dey involved go rewrite di exam.
Jamb Registrar cry sake of technical errors
According to Jamb some errors bin happun for some centres wey affect di performance of candidates during di exam.
Jamb Registrar, Prof Ishaq Oloyede tok for media briefing for Abuja on Wednesday say
"Wetin suppose be moment of joy don change due to one or two errors."
Di Registrar announce say di technical error affect about 379,997 candidates.
"We apologise and assure you say dis incident represent a significant setback for… we remain committed to emerge stronger in our core values of transparency, fairness and equity", Oloyede tok as e cry wen e address tori pipo.
E add say na di function of di exam bodi to admit error sake of say dem sabi say inspite of dia efforts dem no dey perfect.
Some of di errors wey happun include:
Shift from traditional count based analysis
According to one post wey di Educare Tech Team - di team wey chook eye for Jamb core system to check wetin bin happun during di exams share for social media, breakdown di errors.
Dem say one of di "most critical discoveries" wey dem bin make during di session dey around three major systemic changes wey dem introduce for di 2025 UTME.
Jamb change from di traditional count-based analysis to a more robust source-based analysis of results.
Dem explain say before-before, Jamb dey evaluate di integrity of examination sessions primarily by counting di number of responses wey dem submit per session.
If di majority of candidates in a session of 250 bin submit a near-complete set of answers, di session dey valid.
Any significant deviation go lead to disqualification of results from dat centre.
However, for 2025, dem use a more advanced model—wey go focus on di actual source and logic of di answers dem provide, instead of just di quantity.
Full-scale shuffling of both kwesions and answer options: Dis process na to make sure say if two candidates dey siddon for di same session dem no go get identical questions and answers.
Dis na to improve di security of di test.
Systemic improvements: Jamb do plenti systemic improvements wey go improve performance and reducing lag (dragging) during exam sessions.
According to di document, dis na a major policy change wey bring di best and highest UTME score in 15 years.
Dem say na dis technological improvements wey dey really good on paper, cause di major wahala during di implementation phase.
"Di system patch necessary to support both shuffling and source-based validation bin dey fully deployed on di server cluster wey dey support di KAD (Kaduna) zone, but dem bin no apply am to di LAG (Lagos) cluster, wey dey service centres for Lagos and di South-East.
Dis omission happun across all sessions until di 17th session, na later dem discover and korect di error." na wetin engineer James Nnanyelugo submit to di Educare team.
Jamb also assure Nigerians say dis kain tin no go happun again as dem reschedule di exam for Friday 16th and Saturday 17th May, 2025
Jamb candidate lament
Some candidates wey be victims of dis technical errors share dia experience wit di BBC.
Dem tell BBC wetin happun for di examination centres.
"I bin log into almost three computers, but dem kontinu to reject my login, wen I finally get di chance to log in, before I go even read di questions, time don finish.
For my centre na me be di only pesin wit dis issue. Wen I bin start to try ansa di questions, di computer just start to dey go on and off due to technical issues.
I bin complain but dem tell me to manage am like dat, afta somtime my profile just disappear from di system and anoda pesin profile appear."
Di candidate add say di questions of di oda pesin show for di screen too, afta somtime e kon go off completely.
"Wen my computer go off, e no affect only me, e bin affect majority of di students dia.
E bin take somtime before dey solve all di issues and evritin come dey stable again. At di end I no fit answer all di question wen dem tell us say our time don finish becos I waste plenti time sake of di technical difficulties wey I face."
Di story no different from anoda female candidate wey tok say her computer begin go off and on wen she start to write di exam.
"My computer go off like 3 times, den I realise say oda students bin dey also face di same issue. Di result of di exams shock us, some of us pass on an average, but we no get wetin we bin hope for.
We bin study veri hard but den di technical issues from di computers affect our results." She tok.
Hastags of #thisisnotmyresult bin dey trend as candidates use am express dia frustrations.
Nigerians react wit #thisisnotmyresult for social media
UTME 2025 candidate take her life
We no go quantify di impact wey dis technical glitch get on candidates but we fit report say one candidate take her life afta she see har Jamb result, Jamb tok.
19-year-old Faith Opesusi Timileyin been dey hope to study Microbiology for university but dat dream no fit come to pass again as she take her life just aftq she see her 2025 Jamb result.
Faith na one out of over a million young pipo wey write di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination.
Di UTME candidate bin dey wit her sister for Ikorodu, Lagos wen di incident hapun.
Faith elder sister Opeyemi Opesusi describe her as pesin wey dey hardworking, humble and dey always tok her mind.
"Wen she begin dey vomit and I ask her, she tell me say she take poisonous substance. Na for di hospital she leave me," na so her elder sister tok.
Jamb don since come out to admit say error dey for dis year exam wey record mass failure.