Wetin bin cause di NiMet strike wey ground airlines operations

Stranded passengers for Lagos airport
Read am in 4 mins

Di Nigerian Meteorological Agency (NiMET) don end dia strike afta goment meet dem.

NiMet workers bin don I-no-go-gree sake of di poor working conditions – action wy ground flights across di kontri on Thursday.

But dem wit di Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo on Thursday wit oda stakeholders for Abuja bifor dem gree to resume work.

Di workers bin dey worry sake of di non-implementation of di new national minimum wage, den ignore requests to include omitted staff in past allowances, and neglecting key training programmes, among oda matters.

Director General of NiMET, staff of Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA), di National Union of Transport Employees, also attend di meeting.

Di strike wey just happun for two days leave passengers across di kontri stranded especially for di Lagos and Abuja airports wey busy pass.

NiMet work na to provide information about di weather for airlines.

Some local airlines for Nigeria don suspend all dia flights sake of di strike.

Passengers dey on queue to Check-In for di Nnamdi Azikiwe International airport Abuja
Wetin we call dis foto, Passengers dey on queue to Check-In for di Nnamdi Azikiwe International airport Abuja

Airpeace cancel flights

Airpeace na one of di airlines wey cancel all dia flights indefinitely. One video wey bin go viral on Wednesday show wia di oga of Airpeace Allen Onyema tok say make dem cancel all di flights.

For inside di video oga Allen bin dey tok for phone wit pesin we sound like im staff.

Di pesin bin dey ask am for di phone call weda make dem fly, but oga Allen respond in di negative.

Im give order make dem cancel all flights till further notice or wen di Nimet workers resolve dia strike mata.

However, bifor di video, Airpeace for dia official X handle on Wednesday morning bin no announce outright suspension.

Dem bin only tok about flight disruptions wey fit include "...possible flight delays and cancellations...

We dey currently monitor di situation and we dey work wit relevant stakeholders to reduce di impact on your travel plans."

United Nigeria

Meanwhile, di United Nigeria airline say despite di strike dia flight operations still dey available.

For statement wey tok-tok pesin, Chibuike Uloka sign and release on Thursday 24 April for di office handle, United Nigeria Airline say dia flights operations " remain safe, reliable and compliant wit regulatory standards despite di ongoing industrial sction by di Nigeria Meteorological Agency."

Dem say despite di strike dem get alternative sources wey dem fit use get weather reports like real time satellite monitoring, pilot weather reports and coordination wit air traffic control services and more.

Wetin dis statement mean be say, flight operations go continue as usual for United Nigeria Airline across di kontri.

Tori from BBC Pidgin tori pesin wey visit di Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja, di Nigeria capital comfam say activities dey go on for di airport despite di strike.

Our tori pesin wey visit di airport on Wednesday morning say lines like Ibom, Aero, Max air, United Nigeria, and Arik dey fly.

Im see passengers dey check -In as dem also make boarding calls for di airport.

However, passengers of Airpeace wey bin get flights dis morning no fit fly afta dem Check-In.

Dem later tell di passengers wey don already Check-In say dem no go fly, one Airpeace flight wey bin don reach runway and bin dey ready to take-off gatz comeback.

One official of di Federal Airports Authority of Nigeria (Faan) tell BBC Pidgin say besides di order from Airpeace oga Allen Onyema, Airpeace pilots wey many of dem na expatriates dey fear to fly.

Di pilots also say dem no go fit take di risk to fly without a Nimet report, na why dem ground all flights.