10 pipo die, seven injure inside building collapse for Ibadan

Di authorities for Oyo state don confam say one building collapse for part of di state don claim lives of 10 pipo alreadi while eight odas dey fight for dia lives.
Di building collapse bin happun on Thursday 31 October, 2024 for Jegede area of Ibadan, di state capital.
For midnight wen pipo dey sleep around 2am, a storey building wia pipo dey live bin suddenly collapse.
Police neva clear wetin cause di building collapse but dem say dem dey begin investigation into di incident to know wetin lead to am.
According to one eye witness say some parts of di house get pipo wey dey recova from brain-related issues.
According to di statement of di police, na 10 pipo die immediately wen di building bin collapse leaving about eight pipo wit plenti injuries.
"Adequate securiti don currentl dey for di area to prevent make hoodlums no take-ova di scene wia di incident bi happun and also to protect di lives and property of oda residents within di area," di police tok
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Meanwhile, according to di Oyo state fire service, rescue operation still dey go on afta dem rescue some pipo from di collapse.
Di General Manager of di Fire Service, Yemi Akinyinka say dem receive call wey trouble dem around 2am from residents wey say di building collapse don trap many under.
Oyo govment react
Di Commissioner for Housing and Land for Oyo State, William Akin-Funmilayo don visit di scene wia di incident happun.
During her visit to di scene, di commissioner say di incident na result of how di residents no care about di state of di building bifor e collapse.
E say dem no pay attention to di building and e don weak for body wey make am collapse.
Di commissioner add say di Oyo govment go take measures to ensure say dat kain incident no go happun again and dem go do confam inspection of homes to know house wey don weak.

Wia dis foto come from, Jahworthy

Wia dis foto come from, Jahworthy











