Death toll from Lagos mosque collapse rise to three as one adult join teenage girls wey die

Mosque collapse for Papa Ajao area of Mushin

Di Lagos State Emergency Management Agency (Lasema) tok say di death toll from di mosque wey collapse for Yusuf Street, Papa Ajao area of Mushin, don rise to three.

Lasema for one statement wey dem release on di latest development tok say one adult na di third pesin wey die for di incident.

Dis dey come afta di Director of Operations of di Agency Olatunde Akinsanya bin tell BBC News Pidgin for di scene of di incident on Sunday, 26 May, say na two teenage girls die and five odas injure wen di mosque collapse.

E say one of di teenagers die for di scene and di oda one die as dem bin dey carry her go hospital.

For dia latest update on di incident, Lasema say, "Following one extensive exercise, final casualty report on di above incident na 3 fatalities and 7 casualties wey vary in severity.

"Di affected buildings don dey leveled to ground zero."

Dem report say di two-storey building bin collapse sake of one excavator machine wey nack am by mistake as dem dey work on road expansion.

Lasema say prayer bin dey go on wen di building collapse.

As to wetin cause di incident, Lasema say di vehicle wey bin dey dig drainage for di area mistakenly comot di main pillar wey dey hold di structure up.

Dem dey use heavy equipment to help wit di rescue

Wia dis foto come from, Lasema

Wetin we call dis foto, Dem dey use heavy equipment to help wit di rescue

Oda building collapse wey don happun for Lagos

Dis no be di first time building go dey collapse for Lagos.

For April 13, 2023, one video wey go viral show di moment one seven-storey building collapse for Banana Island.

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say upon arrival of dia response team for di scene of di incident, dem see say one seven-storey building collapse.

Di Lagos State Goment bin say dem no approve di building wey suffer dat collapse.

September 4, 2022 bin come wit di collapse of one seven-storey building for di Lekki area of Lagos State for early mor-mor.

About 2 pipo die for di incident wit six odas wey hook for inside di house.

For early May 2022 Ebute Metta collapsed building trap dozens and some pipo die, Lagos authorities confam.

Di three-storey building on 32 Ibadan Street, Ebute Metta area of Lagos collapse on Sunday May 1 for night.

For 1 November 2021, one 21-storey building collapse for Gerrard Road, Ikoyi and kill many pipo while odas injure.

One eyewitness say around 2:25pm dem notice say evriwia bin dey shake and later di tall building fall down.

BBC News Pidgin find out say di Lagos high-rise-building na active construction site wen e crash.

One investigation blame di collapse on di negligence of di agencies wey dey responsible for di approval and supervision of di construction.

Mosque collapse for Papa Ajao area of Mushin