Na truck run into Banana Island building wey collapse - LASEMA

Wia dis foto come from, LASEMA
One video wey go viral show di moment one seven-storey building collapse for Banana Island.
Banana Island na wia di richest pipo dey live for Ikoyi area of Lagos State, Southwest Nigeria.
Di video wey go make you shake show how pipo wey dey ontop of di building follow di building collapse.
Many pipo dey wonder how di pesin wey film di video take sabi say di building wan fall.
BBC Pidgin gada say na seven pipo injure for di incident and dem don rush dem to hospital. Dem still dey find one pesin.
All di victims na construction workers.
As at di time of dis report, rescuers still dey search di rubbles if any pesin still dey under am.
Di moment of di collapse
Tori be say di building wey dey under construction na seven-storey.
End of Di one wey oda users dey read well well
From di video e clear say workers dey work for di site but but nobody die for di building so far.
Di video show about six to seven or maybe even eight pipo on top of di last deck of di building – di building just collapse towards di right side and pipo wey dey on top follow am fall.
Di National Emergency Management Agency (NEMA), say workers bin dey trap for di building.
Di voice from di video just dey shout as di building fall.
Di incident happun on Wednesday evening – rescue operation start as di news spread.
As at Thursday morning, tori come out say dem don bring out seven pipo alive from di rubble
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
'We dey investigate di incident'

Di Lagos state goment say dem no approve di building wey suffer dat collapse.
Tayo Bamgbose-Martins, Commissioner for Physical Planning and Urban Development tok dis one in reaction to di latest mata.
“One unapproved 7-floor building under construction don collapse for Banana Island, Lagos State.
“Few wey sustain injuries don begin take treatment. Nobody die. Dis unfortunate incident happun wen dem dey do casting.
'Na truck cause di collapse'

Wia dis foto come from, LASEMA/FACEBOOK
Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say upon arrival of dia response team for di scene of di incident, dem see say one seven-storey building collapse.
Dem say information wey dem gada reveal say di building collapsed sake of say one truck run into am.
"Fortunately, no loss of life, however, efforts dey go on to reconstruct di building to ground zero sake of to prevent any secondary incident.
"Recovery operations ongoing," LASEMA tok.
Dis kain tin don happun before
Building collapse incident don happun before for Ikoyi area of Lagos State.
For 1 November 2021, one 21-storey building collapse for Gerrard Road, Ikoyi and kill many pipo while odas injure.
One eyewitness say around 2:25pm dem notice say everywia bin dey shake and later di tall building fall down.
BBC Pidgin find out say di Lagos high-rise-building na active construction site wen e crash.
One investigation blame di collapse on di negligence of di agencies wey dey responsible for di approval and supervision of di construction.














