You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Larry Ellison overtake Elon Musk as world richest pesin
- Author, Danielle Kaye
- Role, Business reporter
- Read am in 4 mins
Elon Musk don lose im title as di world richest pesin to Larry Ellison, di co-founder of Oracle and personal pesin of US President Donald Trump.
Ellison wealth bin rise to $393bn (£290bn) on Wednesday morning, as e pass dat of Musk $385bn (£284bn), according to di Bloomberg Billionaires Index.
Shares for Oracle go high to more dan 40% afta di database software company give investors one surprisingly rosy outlook for dia cloud infrastructure business and artificial intelligence deals.
Oga Ellison, wey im net worth dey tied to di company, don steadily build im fortune ova di past five decades.
Musk bin hold di title of world richest pesin for nearly one year. E fit receive a pay package worth ova $1tn (£740bn) if e hit a list of ambitious targets ova di next decade, di board of di electric car firm don propose.
But shares for Musk most valuable business, Tesla, bin fall dis year.
Oga Trump administration roll back on electric vehicle initiative plus di gbasgbos wey Musk receive from im customers sake of im involvement in politics bin affect im electric vehicle business as investors fear to put dia money.
Oracle recently go up sake of di growing demand for data centre infrastructure.
Di company bin project as part of dia quarterly earnings report on Tuesday, 9 September say revenue from dia cloud business go jump 77% dis year, to $18bn, wit further growth expected in di coming years.
Oracle report high demand among AI companies for dia data centres, wey help push dia stock dramatically higher.
Dem sign four multibillion-dollar contracts wit customers in di last quarter and dey look forward to several more deals in di months ahead, chief executive Safra Catz tok on Tuesday.
Trump ties and media ambitions
81-year-old Ellison, bin help start Oracle for 1977 and e become popular for di 1990s, wen e become public figure wey dey known for im lavish lifestyle as for di database company behind im fortune.
E be Oracle chief executive until 2014, and now e be di company chairman and chief technology officer.
And e don position imself as an ally to President Trump.
Wen Trump bin return to di White House for January, Ellison appear alongside OpenAI Sam Altman and SoftBank Masayoshi Son to announce one project dem call Stargate, to build out AI infrastructure for US.
Oracle also don emerge as di possible buyer of TikTok, di app wey Chinese internet company ByteDance be di owner.
TikTok dey face ban for di US unless dem comot diasef from ByteDance ownership.
For January, wen dem ask Oga Trump if e dey open to Musk buying TikTok, E reply say im for: "like Larry to buy am, too."
Ellison media ambitions extend beyond TikTok.
Na im fund di bulk of a $8bn bid by im son to acquire Paramount, wey CBS and MTV own.
Dat deal between Paramount and di media company Skydance, wey im son David, control, bin close last month.
Who be Larry Ellison
Larry Ellison na di chairman, chief technology officer and co-founder of software giant Oracle, company wey e own roughly 40%.
E give up di Oracle CEO role for 2014 afta 37 years as di oga patapata.
For September 2025, e become di second pesin ever to worth more dan $400 billion, thanks to one AI-driven boom for Oracle stock price.
For 2020, Ellison move permanently to Hawaiian island Lanai, e nearly buy all di Island for 2012 for $300 million.
Ellison bin sit on Tesla board from 2018 to 2022. E get 45 million split-adjusted shares bifor e step down as director.
Ellison also get nearly 50% of media giant Paramount Skydance, wey e form afta di nearly $28 billion (enterprise value) merger of Paramount and im son David Skydance for August 2025.
Apart from say e be business guru, Ellison also like to dey race sailboats, fly aeroplanes, and play tennis and guitar.
E grow up for one poor neighbourhood for Chicago. Ellison don marry three times and e be one of di most colourful figures for di industry.