Sabi pipo reveal true colours of Neptune and Uranus for di first time

Wia dis foto come from, University of Oxford
Wetin we bin tink say di planets, Neptune and Uranus resemble, dey wrong, according to research wey UK astronomers bin lead.
Pictures from one space mission from di 1980s show say Neptune na blue in colour and Uranus dey green.
But one study don discover say di two ice giant planets both be similar shades of greenish blue.
Tori be say dem touch up di earlier images of Neptune to show details of di planet atmosphere, wey change im true colour.
Prof Catherine Heymans, Astronomer Royal for Scotland and a University of Edinburgh astrophysics professor tell BBC Radio 4 say, "dem do wetin I think everibodi for Instagram don do at some time for dia life, dem filter di colour".
"Dem enhance di blue so dem go fit reveal di features wey you fit see for di Neptune atmosphere, na why e look very blue, but true-true Neptune resemble Uranus well."

Wia dis foto come from, JULIAN BAUM/SCIENCE PHOTO LIBRARY
Astronomers don sabi tay-tay say most of di newest pictures of di two planets no show di real colours, according to Prof Patrick Irwin from University of Oxford wey lead di research.
"Even though sabi pipo - planetary scientists bin know di artificial colour at dat time, and di pictures dem bin release am with caption wey explain wetin happun wit di picture, dat explanation don loss over time."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dr Robert Massey wey be di deputy director of di Royal Astronomical Society (RAS), tok say to enhance pictures na normal tin for astronomical research.
"You go dey foolish to look astronomy picture and not tink say dem don boost di colour. Dem need to do am, na how dem dey take process am to fit see tins. No be say conspiracy dey to keep am from public."
Prof Irwin and im team bin process di original data to produce wetin dem claim say na "di most accurate representation yet" of both Neptune and Uranus.
Di first confusion bin comot because pictures wey di Nasa Voyager 2 spacecraft bin take of di two planets bin dey recorded in three different colours.
Di pictures bin dey recombined to fit get di colour picture wey dem no balance wella. Dem use contrast wella so dem fit comot details for di clouds and di bands and di winds of di planets. For Neptune, di process dem use make di planets blue pass wetin e be.
For di recent study, di researchers use data from di Hubble Space Telescope Imaging Spectrograph and di Multi Unit Spectroscopic Explorer on di European Southern Observatory Very Large Telescope.
With both instruments, everi pixel na continuous spectrum of colours wey helep di researchers to fit find di true colours of both planets.
Di analysis reveal say Uranus get shade of greenish blue but Neptune own colour come get blue on top according to researchers.
Di study show say Uranus dey greener for winter and summer wen one of im poles dey face di sun. But for spring and autumn, wen di sun don pass di equator, e dey more blue.
Di research dey published for di Monthly Notices of di RAS.













