Space telescope show planet Jupiter fotos

Wia dis foto come from, NASA/ESA/CSA/Jupiter ERS Team/Judy Schmidt
Di world largest and most powerful space telescope don reveal ogbonge fotos of Jupiter.
James Webb Space Telescope (JWST) bin take di fotos of di Solar System biggest planet for July.
Di fotos show auroras, giant storms, moons and rings wey surround Jupiter in detail, experts describe di foto dem as "incredible".
Di infrared images dey artificially coloured to make di features stand out.
Dis na because infrared light dey invisible to human eye.
"We never seen Jupiter like dis. E dey really incredible," na so planetary astronomer Imke de Pater, of University of California, wey bin play a key role for di project tok.
"We no really expect am to dey dis good, to be honest," she add.
Di $10bn (£8.5bn) JWST na international mission wey US space agency Nasa dey lead and get partners from di European Space Agency and di Canada Space Agency.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nasa say in di stand-alone view of Jupiter, dem create am from several images from telescope, auroras extend to high altitudes above both di northern and southern poles of Jupiter. Auroras na light shows for skies above di planet caused by interactions wit particles wey dey stream away from di Sun.
Meanwhile, di Great Red Spot, a famous storm wey big wey fit swallow di Earth, appear in white. Dis na because it reflect a lot of sunlight.
Dem launch di JWST for December 2021, and e dey currently positioned about one million miles (1.6 million km) from Earth.
E fit detect light wey begin travel towards Earth 13 billion years ago, shortly after di Big Bang.
Dem view as di successor to di famous Hubble telescope, di JWST dey expected to be a dominant force for discovery in the next 20 years.












