You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wagner boss Yevgeny Prigozhin ‘dey inside’ Russian plane wey crash, nobody survive
Wagner boss Yevgeny Prigozhin dey on di passenger list of one jet wey crash and kill all di pipo wey dey on board, Russia civil aviation authority tok.
Earlier, Wagner-linked Telegram channel Grey Zone report say di Embraer aircraft go down afta air defences shoot am for di Tver region, north of Moscow.
Di jet wey bin dey fly from Moscow to St Petersburg dey carry seven passengers and three crew members.
Prigozhin bin lead a failed mutiny against di Russian armed forces for June.
Grey Zone tok say local residents hear two bangs before di crash and see two vapour trails.
Tass news agency tok say di plane catch fire afta hitting di ground, and add say dem don find four deadi bodi already.
Di aircraft bin dey for air for less 30 minutes, dem tok.
Di 62-year-old mercenary boss bin head di mutiny on 23-24 June, and im move im troops from Ukraine and seize di southern Russian city of Rostov on Don, and threaten to march on Moscow.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis one happun afta months of tension wit Russian military commanders ova di Ukraine conflict.
Dem settle di stand-off wit one deal wey allow Wagner troops to move to Belarus, or join di Russian army.
Prigozhin imself agree to relocate to Belarus but im bin dey able to move freely, and make public appearance for Russia and release video of imsef wen im reportedly dey Africa.
But several Russia watchers don describe am as "dead man walking" since di mutiny.
President Putin initial reaction to im challenge to Russia defence establishment dey bitter, as im call di challenge betrayal and a stab for back for one video message on 24 June.
Di deal no mean say im safe.
"Revenge na food wey Putin prefer make dem serve cold," CIA director William Burns tok for im comment.
None of dis, of course, proove say Prigozhin and im entourage dey deliberately targeted.
But sake of di circumstances, any claims say im death na accident go make pipo ask questions.
Who is Yevgeny Prigozhin
Yevgeny na one ogbonge player for Russia full-scale invasion of Ukraine, e bin dey in charge of a private army of mercenaries - di group name na Wagner Group - leading di Russian onslaught in key areas of di war.
Na from Vladimir Putin home city of St Petersburg e come from.
Dem sama am im first criminal conviction for 1979, wen e bin dey just 18, and get a suspended two-and-a-half year sentence for theft. Two years later, dem sentence am to 13 years for jail for robbery and theft, nine of which e bin serve behind bars.
Afta e don spend some time for prison for theft, Prigozhin set up one chain of stalls wey dey sell hot dogs for St Petersburg. Business boom well-well and within a few years, for di lawless 1990s, Prigozhin dey able to open expensive restaurants for di city.
Later, dem contract Prigozhin catering company Concord to supply food to the Kremlin, wey earn am di nickname "Putin chef".
Oga Putin trust Prigozhin so tey e invite am to celebrate im birthday on New Island for 2003.
After years of denying say Wagner even exist, on 27 July 2022 Kremlin-controlled media suddenly admit say e dey fight for eastern Ukraine.
Prigozhin also start posting videos on social media - ones wey e apparently film for occupied parts of Ukraine - wia e bin dey boast of Wagner's exploits dia.