'Na fear make us tok say we agree to marry' - TikToker Mai Wushirya

A man and a woman holding each other

Wia dis foto come from, @Maiwushiryabackup/TikTok

Read am in 4 mins

Nigerian TikToker Mai Wushirya don tok for di first time about im planned marriage wit Yar Guda Daya afta one Magistrate court for Kano tell Hisbah say make dem ensure say di two pipo marry within 60 days.

For one video wey trend on social media, Mai Wushirya explain why e tell court say im and Yar Guda love each oda and ready to marry.

Di court give dis order afta videos of Mai Wushirya and Yar Guda go viral for social media wey Kano State Film Censorship Board call "dirty and immoral".

Di videos show how di two TikTokers dey show love and affection for public, somtin wey di state authorities say no follow moral value, religious teaching, and di culture of pipo for Kano State.

"All dis wahala wey dey happun between me and Yar Guda Daya di girl wey I dey do comedy video wit start sake of of small misunderstanding wey happun during our work. Na di Censorship Board summon me; dem tok make I come. No be say dem arrest me," e tok.

E say e go dia by imsef becos e believe say dem go show justice and pity, since wetin im do no be big offence.

"But dem kon tok say dem go just 'correct' me small, say oda pipo don do worse pass me and notin happun to dem."

Mai Wushirya say e no understand why im own mata kon turn like dis. As for dis marriage tok, e say even im lawyers neva collect any statement from am say e agree to marry her, becos dem sabi say e no wan marry.

"Na fear of di case make me tok like dat, I dey afraid say dem fit do somtin wey go disgrace me.

"For my family, na me be di last born. How dem go tok say na 'forced official marriage' I dey enta? Even my friends don dey laugh me say dem dey force me marry. I fear well well say dis marriage fit be di worst regret for my life.

"Di reason why I dey do comedy video wit dat girl na becos she need help. Her situation no easy, and na only God plus some kind pipo dey help her. I just carry her close becos I pity her," e tok.

No court fit force two pipo to marry - NBA

Meanwhile, di Nigeria Bar Association (NBA) say no court get di power to compulsory two pipo to marry.

"E dey unconstitutional and unlawful for any court to get power to give dat kain order."

NBA President Mazi Osigwe (SAN) give dis reaction afta one Magistrate court for Kano order two popular TikTok content creators, Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda, to formalise dia relationship through marriage within 60 days.

Di court bin give dis order afta videos of Mai Wushirya and Yar Guda go viral for social media wey Kano State Film Censorship Board call "dirty and immoral".

Oga Osigwe say dis development show grave misunderstanding of di limits of judicial authority under di Nigerian Constitution and e go against di fundamental rights of di individuals concerned.

E call for immediate review of Magistrate Halima Wali decision and ask di relevant judicial authorities to take steps to prevent a recurrence of such unconstitutional orders.

Who be Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda?

Idris Mai Wushirya na from Kano, and na for di state e dey live.

E do im primary school for Kano, den later go do secondary school for Katsina State.

E popular for TikTok wia e dey post videos wey pipo say dey contain bad tok and immoral content wey dey always cause plenti tok-tok for Kano.

No be di first time authorities for Kano don accuse or arrest am. Dem don catch am many times sake of videos wey dem say no follow good morals.

Sometimes, Hisbah pipo and Kano Film Censorship Board go call am and oda TikTokers wey dem believe no dey behave well for social media, to advise dem.

But dis time around, di TikTok video wey e post make dem carry am go court.

Meanwhile, Basira Yar Guda come from Zamfara State. She don popular for social media inside Kano, sake of say pipo for Kano dey always post her videos for dia pages.