Court grant Omoyele Sowore bail, police rearrest am again

Wia dis foto come from, Omoyele Sowore/Facebook
Police don re-arrest activist Omoye Sowore just afta court grant am bail for Abuja.
Magistrate court bin grant Sowore bail afta im initial arrest on Thursday.
Di court bin grant am bail wit di conditions of two surety to di sum of 500,000 naira ($342). Court say di surety gatz get valid means of identification and three years tax clearance.
Odas wey dem grant bail include 13 wey dem arrest bifor including Nnamdi Kanu broda and lawyer.
Howeva, police bin gbab Sowore again as e dey meet im bail conditions.
Barr Nnaemeka Ejiofor confam say dem don rearrest Sowore again.
"Dem carry am comot while dem destroy di table and oda properties of one vendor for di court compound."
Dis new arrest na afta di previous arrest wey di Nigerian police bin do.
How dem arrest Sowore bifor
Di Nigeria Police Force bin arrest Sowore on Thursday
According to reports, armed policemen wey dey within di premises of di Federal High Court for Abuja, di kontri capital bin arrest Sowore on Thursday, 23 October, shortly afta e show for court to support to di detained leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), Nnamdi Kanu.
Di Force tok-tok pesin Benjamin Hundeyin wey confam di arrest as e dey follow tori pipo tok, say di activist currently dey police custody and dem go charge am to court as soon as possible.
E explain say di reason why dem arrest Sowore na becos all di 13 pipo wey dem earlier arrest on top accuse say dem allegedly violate one court order wey restrict protests around di three arms zone for Abuja mention im name for dia statements, say na im lead dem go di restricted area in contravention of di court order.
"E no go dey fair to charge some pipo to court and leave di pesin wey be di lead protester, wey carry dem go di restricted area to commit di crime. And dat na why in di spirit of fair play and to ensure say justice dey served, we arrest Omoyele Sowore today, and like di odas too, e no go spend up to 24 hours wit us, once we wrap up di charges, we go prosecute am, if evritin go well, our plan na make e dey prosecuted today," Hundeyin tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Na human rights lawyer Inibehe Effiong dey among di pipo wey bin first raise alarm say Nigeria Police don gbab di former presidential candidate.
Sowore arrest come three days afta e lead one protest wey demand di release of di leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (Ipob).
"Di arrest of Omoyele Sowore for di Federal High Court for Abuja moments ago dey preposterous," Barrister Effiong write on X and demand immediate release of di human rights activist.
One video wey don go viral show wen police officers take Sowore away from di premises of di Federal High Court for Abuja afta im appear in solidarity wit di detained leader of di proscribed Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu.
Meanwhile, during dat #FreeNnamdiKanu protest wey hold on Monday, 21 October, police bin arrest Kanu lawyer, Aloy Ejimakor, im brother, Emmanuel Kanu, plus ten odas and detain dem for Kuje Prison.
On Tuesday, 22 October, one Magistrate Court for Kuje, Abuja, bin order say make Emmanuel Kanu, Aloy Ejimakor plus di oda arrested protesters remain for jail.
Di Nigeria Police Force charge dem wit two-count offence of inciting public disturbance and breach of peace, sake of di protest dem follow do.
According to di charge sheet, di suspects allegedly block road, deny citizens dia right to free movement, and chant war songs as dem dey demand di release of Nnamdi Kanu.
Sowore bin accuse security operatives say dem launch unprovoked attack on peaceful protesters during di #FreeNnamdiKanu rally for Abuja.
Which order Sowore plus di oda protesters allegedly contravene?
Ahead of di #FreeNnamdiKanu, di Nigeria Police Force bin release one statement wey urge protest groups to respect court order.
According to one statement wey Hundeyin sign and post on im official X account on Friday, 18 October, Justice MG Umar of di Federal High Court, Abuja Division bin give one ruling on Thursday 17 October wey stop any pesin or group from staging protest for certain areas within di FCT.
Di areas include:
- Within and around Aso-Rock and im environs
- National Assembly Complex
- Force Headquarters
- Di Court of Appeal
- Eagle Square
- Shehu Shagari Way
Di police bin call on all groups - weda dose wey dey support di agitation for di release of Mazi Nnamdi Kanu or against am to adhere strictly to di provisions of di court order.
"Accordingly, all intending protesters and counter-protest groups dey strongly advised to avoid restricted areas and to refrain from any act capable of provoking confrontation or disturbing public order," di police bin warn for di statement.
Di statement add say police go arrest offenders, carry out investigation, and prosecute dem under relevant criminal laws, wey include laws wey relate to public order, violent conduct and terrorism wia applicable.
Dose wey dey social media no dey spared as police say dem go use digital evidence investigate and prosecute dem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Who be Sowore?
Omoyele Sowore na journalist, human rights activist wey bin don follow contest for Nigeria presidential election.
E don collect plenti arrest and detentions ova di years.
Im be di RevolutionNow leader for Nigeria and Publisher of Sahara Reporters news platform.
Nigeria govment bin arrest Sowore for August 2, 2019 say im commit treason.
Dem later release am on 5 December afta e spend more dan 3 months for detention, only to re-arrest am inside court less dan 12 hours later.
On 13 December, 2019, Attorney General of Nigeria and Minister of Justice, Abubakar Malami bin take ova di case of Sowore from di kontri Department of State Service.
Den on December 24, DSS release di publisher afta oga Malami write to di DSS say make dem release am.
Dis latest arrest don add to plenti of im arrest timeline.










