Wetin be di difference between antisemitism and anti-Zionism?

Members of the Jewish community attend a vigil for the victims of the recent attacks in Israel at Central Library, St Peter's Square, on 11 October 2023 in Manchester, United Kingdom

Wia dis foto come from, Getty Images

As di Israel-Gaza kasala dey continue, plenti pipo social media wan sabi wetin be di difference between antisemitism and anti-Zionism.

Wetin be di meaning of di words gan-gan?

  • Antisemitism mean judgement against di Jewish pipo wey don dey ground for centuries
  • Anti-Zionism fit dey generally defined as pipo wey no wan gree to di existence of di state of Israel
Clashes between Palestinians and Israeli police at Jerusalem's Al-Aqsa mosque compound in 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kasala burst for 2021 for di al-Aqsa Mosque, di third holiest site in Islam and also di holiest place for Jews, wey dem dey call Temple Mount

Wetin be antisemitism?

Jewish pipo don face enmity and persecution for centuries.

During World War II, Nazis bin kill six million Jews for wetin dem call di Holocaust.

Now, antisemitism get plenti types wey include conspiracy theories about Jewish control of di global financial system and di media, attacks for synagogues, verbal abuse or hate speech, or abusive memes for social media.

Sometimes pipo wey get different views on Israel dey argue about weda some tins dem tok na antisemitic or not. Most times dis kain tok dey involve di word, "Zionism".

A group of child survivors at the Nazi concentration camp at Auschwitz-Birkenau, 27 January 1945

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Holocaust na period for history wey millions of Jewish and oda pipo die for Germany Nazi party hand

Wetin be Zionism?

Zionism start as political movement for Europe for di late 19th Century. Dem bin wan build Jewish nationhood for di land wey dem call Palestine - wey Jews bin know as di ancient Land of Israel.

Di UN recommend make dem divide Palestine to Jewish and Arab state and for 1948, dem declare di State of Israel.

But many Arab pipo wey dey live for Palestine and di surrounding arears no gree for Israel as di Jewish nation.

Different kinds of Zionism dey, for instance some Zionists believe say Israel get right of land wey dey outside dia territory but oda Zionists no gree.

Many Jewish pipo support or sympathise wit di koko of Zionism wey be say Jewish state suppose exist for wetin now be Israel. Some no gree for Zionism sake of religious or political reasons.

Non-Jewish pipo fit be Zionists too.

Prime Minister David Ben-Gurion reads the proclamation declaring the existence of the new Jewish State

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Israeli Prime Minister David Ben-Gurion dey declare di new Jewish State of Israel for 1948

Wetin be anti-Zionism?

Anti-Zionism, in general, na di opposition of di existence of di state of Israel.

E get Zionists wey be critics of Israel goment policies like di occupation of West Bank, di route of separation barrier (wey Israel dey build around di West Bank wey dem say na for security against Palestinian attackers but Palestinian supporters say na scope to gbab land) and di building of settlements.

For some cases, wen pipo don criticise Israel badly, e dey hard to know weda na antisemitism cause am.

Dis na wetin don lead to accuse say anti-Zionism wey be di rejection of di Jewish state na just new style of antisemitism. Di International Holocaust Remembrance Alliance say some of di claims and accuse of Israel na antisemitism.

Di pipo wey no gree for dis idea say di argument na scope from Israel supporters to take close di mouth of reasonable critics of Israel by just saying di critic na racism.

Some say "Zionist" fit dey used as coded attack on Jewish pipo, while odas say di Israeli goment and dia supporters dey confuse anti-Zionism and antisemitism on purpose so dem no go fit drag dem.