Profile of Lucky Aiyedatiwa: From classroom to becoming Ondo state govnor

Ondo state govnor Lucky Aiyedatiwa

Wia dis foto come from, Lucky Aiyedatiwa/Twitter

Lucky Orimisan Aiyedatiwa na di newly sworn-in govnor of Ondo state and im emergence into dat office na rare one for di political history of di state.

Dem swear am in afta di death of Govnor Rotimi Akeredolu from prostate cancer.

Like im first name ‘Lucky’ mean, plenty pipo don tok say na luck bring am to di position of govnor of Ondo state. Even im middle name ‘Orimisan’ wey mean ‘my head is good’ fit also dey work for im life.

Lucky Aiyedatiwa na native of Obe-Nla for Ilaje Local Government Area of Ondo State. Dem born am on 12 January, 1965 into di family of Mr. Titus Akande and Mrs. Rosanah Moyebi Aiyedatiwa (of blessed memory).

Between 1970 to 1976, Aiyedatiwa bin attend Saint Peter’s UNA (now FAC) Primary School, Obe-Nla/Obe Adun in Ilaje for im elementary education and in 1982, im go Ikosi High School, Ketu, Lagos for im secondary education.

Still hungry for more, Aiyedatiwa proceed go Lagos State College of Education (now Adeniran Ogunsanya College of Education), Ijanikin for 1986, wia e study Economics and Government and collect im Nigeria Certificate in Education (NCE).

Di new govnor become classroom teacher wia e teach for a period of time before e enta business and establish im own business for 1996.

Aiyedatiwa bin join politics for 2011 wen e become member of Action Congress of Nigeria (ACN) den All Progressives Congress (APC) for 2014.

Former President Muhammadu Buhari bin appoint Lucky Aiyedatiwa as Federal Commissioner wey go represent Ondo State for di Board of Niger Delta Development Commission (NDDC) between 2018 to 2019.

For di 2015 presidential and national assembly general election, im become di APC House of Representative candidate for Ilaje/Ese-Odo federal constituency, afta im represent Ondo state as delegate for di party national convention wey happun for 2014.

From 2004 reach 2010, Aiyedatiwa bin serve as National Public Relations Officer (PRO) for Association of Bureau De Change Operators of Nigeria (ABCON) and chairman of south-west zone of ABCON from 2010 to 2011.

For 2021, Chartered Institute of Local Government and Public Administration of Nigeria (CILGPAN) give platinum award to Aiyedatiwa and before dat, im serve as MD/CEO of Blue Wall Group of Companies wey get about three oda company under am.

For 2001, im attend University of Ibadan for im advanced diploma in Business Administration before becoming an alumnus of Lagos Business School – Pan Atlantic University, Lagos for 2009 wia e get post graduate certification for Chief Executive Education (CEP) in Business Management.

For 2013, im also bag im Masters degree in business Administration from di University of Liverpool, United Kingdom.

In February 2021, dem swear-in Akeredolu and Aiyedatiwa as govnor and deputy afta dem win di October 2020 govnorship election for Ondo state.

For 2023, na two times Aiyedatiwa become acting govnor of Ondo state - first in July 2023 wen di late Govnor Rotimi Akeredolu bin dey medical leave den December 2023 wen President Tinubu finally bin chook mouth say make dem transfer power to am.

Same December 2023, few weeks wey Aiyedatiwa collect power as acting govnor of Ondo state, dem swear am in as govnor following di death of di incumbent Akeredolu wey pass on due to cancer.

Lucky Aiyedatiwa sworn in as Ondo state govnor afta Akeredolu death

Wia vacancy dey for di office of di govnor as a result of death, di deputy govnor go take ova di govnorship seat in accordance wit di constitution.

So following di death of di Ondo state Govnor, Rotimi Akeredolu, im deputy, Lucky Aiyedatiwa dey sworn in as govnor.

Dem swear in Lucky Aiyedatiwa as govnor for one ceremony for di goment house, Alagbaka, Akure on Wednesday.

Di Chief Judge of Ondo state, Justice Olusegun Odusola swear in Aiyedatiwa hours afta di death of di former Govnor Rotimi Akeredolu wey happun early mor-mor on Wedsneday.

During im first speech, as di govnor of Ondo state, Aiyedatiwa say im sympathise wit di Akeredolu family as im accept di responsibility of di state as di new govnor.

Oga Aiyedatiwu describe di former govnor of Ondo state as man of courage and conviction wey dey always speak truth to im own detriment.

Di govnor tok say di pipo go continue to thank Akeredolu for im effort to set up Amotekun as dis don strength security in di region while im also commend am for all im effort for in health, industrial, and education sector.

“I remember wen we bin get case for court to challenge our second term victory, im still pursue di mata of placing strong of security network for di pipo of south west, wey dem dey call Amotekun,” oga Aiyedatiwa tok.

“Dis na di first time (Ondo state) we dey get transition within one administration. Today event don place burden on all of us to put togada our state as one becos we get di responsibility to continue to sustain di legacy of Alakurin Oluwarotimi Odunayo Akeredolu, wey be good governance.”

Oga Aiyetidawu also tok about di developmental contribution of former govnor Akeredolu to di state while im assure di residents of di state say im go continue to prioritize di welfare oif di pipo.

“We go always place di pipo first for any decision wey we take. Na my prayer make God grant di family and pipo of Ondo state di fortitude to bear dis lost,” Aiyetidawu tok.

Before now, one constitutional lawyer, Festus Ogun wey follow BBC Pidgin tok bin say Section 191 (1) of di 1999 Constitution state say dem go immediately swear in di deputy. E say di operative word “shall” for di constitution, no give room for delay or discretion. “E command mandatory”, e tok.

Oga Ogun add say afta Aiyedatiwa take im oath of office as govnor, e go nominate a new deputy govnor wey go dey subject to approval by di State House of Assembly.

Govnor Rotimi Akeredolu

Wia dis foto come from, Govnor Rotimi Akeredolu/Facebook

Meanwhile, tributes don pour in for di late governor wey die for office.

Chairman of di Nigeria Governor’s Forum, Abdulrahman Abdulrazak wey also be di govnor of Kwara state express im sadness on di death and describe di late Akeredolu as an exceptional statesman wey make ogbonge marks for public service.

Oda govnors and politicians also don begin express dia condolences on di passing of di great political icon.

67-year-old Akeredolu bin battle wit health challenge before im death. E bin take sick leave for months to go for medical treatment abroad.

Dem first fly Aketi as many pipo dey fondly call am go abroad for treatment for June. E return back for September and say im still dey recover and dey get beta. E post for Facebook say ‘I am back’.

Afta im return, reports say e stay for Ibadan, Oyo state capital, south-west Nigeria instead of im state, Ondo, dis one bin raise plenty eye brow and raise public concerns on di state of di health of Govnor Akeredolu.

Oda Nigerian political leaders wey die for office

Former Nigeria president Umar Yar'Adua

Wia dis foto come from, Getty Images

Dis no be di first time wey govnor or president go die for office for Nigeria.

One former Nigeria President, Umar Yar’Adua also die for office for May 2010 at di age of 58.

Dem interrupt one Nigerian national television broadcast wit di announcement of im death.

"Di president and commander-in-chief of di armed forces Al-Haji Umaru Musa Yar'Adua die a few hours ago for di presidential villa. Security aides don notify di National Security Advisor General Aliyu Gusau. Gusau don give di informate to di acting president. Di late president bin dey sick for some time. We go bring you official statement as soon as possible," di announcement bin tok.

Di announcement no give official cause of death.

However, President Yar'Adua bin dey suffer from kidney disease. E spend months for one Saudi hospital wia im bin dey receive treatment.

For im absence, Nigerian lawmakers bin make di den vice president, Goodluck Jonathan di acting president.

Afta di death of Yar’Adua, dem swear in im vice, Goodluck Jonathan as president not long afta.

Patrick Ibrahim Yakowa (1948–2012)

Patrick Yakowa bin serve as govnor of Kaduna state from 2010 to 2012 wen e die inside one helicopter accident.

E die on 15 December at di age of 64 for di southern delta region, alongside five oda senior officials, im party tok.

Govrnor Patrick Ibrahim Yakowa and former national security adviser Gen Owoye Azazi bin dey for di helicopter wey crash for Bayelsa state.

Oda pipo for di accident na Dauda Tsoho and Mohammed Kamal, both aides, plus di two pilots: Muritala Mohammed Daba and Adeyemi Sowole.

Nigerian media tok say na Nigerian navy get di helicopter wey bin dey carry di officials go Port Harcourt.

Dem appoint oga Yakowa as deputy govrnor for July 2005, and e return as deputy govnor for April 2007 election.

Dem swear am in as govnor on 20 May 2010, as e take ova from former Govnor Namadi Sambo wey become vice president to den President Goodluck Jonathan earlier.

Afta di death of Yakowa, di state Chief Judge, Justice Rahila Cudjoe swear in im deputy, Mukhtar Yero di following day.

Mamman Bello Ali

Mamman Bello Ali bin represent Yobe South Senatorial District between 1999 and 2007 and e serve as di chairman senate committee on public account.

E contest and win di govnorship election for Yobe for 2007 under di defunct All Nigeria Peoples Party (ANPP) and bin dey office until im death for 2009.

E die of leukemia as e dey receive treatment for one hospital for abroad.

Isiaka Adeleke (1955–2017)

As at di the time of im death, Adeleke bin dey represent Osun West Senatorial District for di National Assembly.

E die for April 2017, at 62, for one hospital for Osogbo afta one political meeting wey last for hours.

Until im death, Oga Adeleke chair di Senate Committee on capital market.

E bin dey di Senate for di second time.

Oga Isiaka for 1991 also dey elected as govnor of Osun State.

Senator Bayo Osinowo (1955–2020)

Better known as Pepperito, Osinowo bin die of complications from COVID-19 on 15 June, 2020.

E be di lawmaker wey bin dey represent Lagos East Senatorial District and Chairman of di Senate Committee on Industries.

Osinowo, die at di age of 64, e bin also serve as Chairman of Lagos State House of Assembly Committee on Lands and Housing for 11 years.

Rose Oko (1957–2020)

Until her death for March 2020, Rose Oko bin serve as senator wey dey represent Cross River North Senatorial District.

She also be di Chairman of di Senate Committee on Trade and Investment.

Oko die for one facility for di United Kingdom weeks afta battling wit high blood pressure.