Lamine Yamal get better record but e legacy go fit reach Messi own?

    • Author, Alex Bysouth
    • Role, BBC Sport Senior Journalist
  • Read am in 9 mins

Di future dey bright as we don dey see pickin wey be genius.

Compare di boy wey get hair band dey celebrate for Ronaldinho im back, di pickin wey don dye im hair blonde wit braces for teeth as im scata di Inter Milan defenders.

Na almost 20 years wey separate Lionel Messi im first goal for Barcelona and di ogbonge semi-final goal wey Lamin Yamal bin score against Inter for im 100 game for di Catalan team last Wednesday.

Messi for 2005 na di youngest scorer for La Liga history wen im use Ronaldinho assist take chip di ball ova di keeper, wen im dey 17 years, just one month younger dan Yamal now.

But Yamal for dis same age, already don win di European Championship wit Spain and one La Liga, Copa del Rey and Super Cup wit Barcelona.

"I no wan compare myserf to di best player for football history," na so Yamal tok bifor im play dat ogbonge game against Inter Milan wen im score one goal to lead Barcelona to stage comeback from 2-0 to 3-3.

But many pipo tink say im fit to reach di level of Messi wit di way tins dey go.

Di stats don dey show say Lamin dey rise fast fast pass Messi and im oda superstar rival Cristiano Ronaldo, since im first game when im dey only 15 years and 290 days.

Yamal don reach 100 games for Barcelona wit two months to im 18th birthday.

By dis same age, Mess score only one goal for nine games wit Barca wia Ronaldo score five gaols for 19 games for Sporting.

Yamal get 22 goals wit 27 assists at im age, wia im gat four more goas from 19 games for Spain.

Messi and Ronaldo no play for dia national teams until dem reach 18 years.

Messi reach 100 games for Barcelona afta im reach 21 years, wit 41 goals, even tho im make im debut at 16 years.

But later im go score 672 goals for di club, gbab eight ballon d'ors, one world cup, two copa America titles and four champions league trophies wit plenty oda domestic titles.

Former Barca midfielder Mark van Bommel tok say wetin Yamal dey do at dis age "neva be normal, na so everibodi don dey tok im mata. But to reach di level of Messi, neva be easy."

Yamal gat more of 'Ronaldo' character

Messi na di small pickin wia don arrive from Argentina when im dey 13 years; na so im bin dey need medicine wia go make im grow – Gerrard Pique tok say at di time, dem tink say Messi "no fit to talk sake of im no tok anytin to anybody for di first month."

"Messi always dey careful how im dey approach tins – di opponents, im teammates, di staff, di managers – im always dey respect," sabi pesin for Spain Guillem Balague explain.

Yamal don grow up 20 miles along di coast from di Nou Camp between di city of Granollers, wia im mama don dey live, and Mataro, wia im papa dey live.

Im dey celebrate im goals by using im fingers to show di number 304, di last three digits for im postcode for di Mataro neighbourhood for Rocafonda.

Pictures don comot on top social media of when Yamal na baby wia Messi, wia chop 20 years at dat time, bin dey hold am during one photoshoot for Barcelona Unicef for 2007.

Seven years afta dat, di baby don dey train wit di club; by 12 years, di media for Spain don already begin to dey compare am to Messi.

Barca serf don break dia protocol when dem bring Yamal say make im stay for La Masia – usually di rooms na for players wey don dey stay outside Catalonia, wey dem dey provide taxi for di local pickins.

Ova three years afta Yamal bin move to La Masia im play im forst senior game against Real Betis.

Former La Masia coach Pau Moral explain say dem "put Yamal for La Masia sake of coaches dey to train am well, di way Barca dey train pickins, now im na correct baller sake of Barca help am well well."

Yamal now bin comot di Barcelona apartment wia im buy house wia dey close to di training ground.

Balague explain say "di fact say im parents bin separate long ago, wia im mama get values, wey im papa dey like im friend – dat allow am to get di freedom to go beyond wetin pipo expect."

Oga Balague dey describe Yamal as "pesin without fear" wia pipo don see during Yamal im press conference bifor di fIrst leg of di champions league semi-final wia end 3-3 wit Inter.

"I don leave all my fear for di park wia dey my neighbourhood," Yamal tok bifor im respond to pipo wia chook mouth for im celebration afta dia copa del wey victory against Real Madrid last month.

"As long as I dey win, dem no fit tok much."

Balague tok say dis na "Cristiano Ronaldo behavior – tinking "na me be di best, so e neva be problem.' But im still be pickin for many tins."

Balague add say di time electricity don cut for Spain last week, Yamal, Gavi and Fermin Lopez don waka around town wit dia hoodies, bifor pipo bin spot dem.

"Dis na tins he go do sometimes wia im no sabi di impact; im also go Rocafonda di last time, wia im notice say im no fit to dey go dia anymore sake of im now become legend. Im don conquer di world."

'Yamal na di best player for di world now'

Di late Kobe Bryant bin tok one tori about Ronaldinho wen im introduce am to one player im tok say go become di greatest player of all time. "Na you be di best," na so Kobby respond but Ronaldinho tok say no, "na dis pickin go become di best."

At di time, Messi bin dey 17 years, but di pipo around am already sabi say im be star.

Im join squad wia gat pipo wia win world cup, like Ronaldinho, Juliano Belletti and Edmilson, oda stars like Samuel Eto'o and Deco and odas wia comot Spain like Carles Puyol, Andres Iniesta, Victor Valdes and Xavi.

Di next season, Barca bin win di La Liga and champions league – even tho Messi miss dat final wit injury – na dia first trophy for di European competition since 1992.

"We win di Champions League and La Liga wit Ronaldinho when im dey im prime," Van Bommel tok. Na im dey di level wia im fit do anytin on im own. We just go defend and make im do di rest for di attack, na so we sabi say we go win every game."

Na difficult tin to compare players of different era. Yamal don comot at different time for Barcelona, at di time when di club no get moni wia dem dey use dia academy players from dia youth system.

Yamal bin get im first game afta Ousmane Dembele don comot di team wia im join Paris St-Germain, wia Raphinha bin dey suspended. Now im be star.

Moral di former youth team coach tok say "as a player and a talent, I tink say we bin dey in front of di best player for di world now." Nobody dey do wetin im dey do at dis age. Lamin na player you sabi say im fit do sometin special."

Yamal don score five goals for di champions league dis season, wia opta records show say im gat 44 shots and 78 dribbles – di most for pesin wey be pickin like dat for di competition.

Di data from di past dey show say for di 2006-07 season, Messi wen im dey 19 years bin make 21 dribbles at di rate of 4.9 per 90 minutes, if una compare to Yamal im 7.2 per 90 minutes dis term, you go see say Yamal im figures don high.

Messi bin miss half of di 2006-07 season wit injury but im still get 26 games wit 14 goals wia im shot rate na 23% wit 38 chances and 2 assists.

Yamal na two years younger Messi but im play 31 games dis season wit six goals, 12 assists wia im create 57 chances.

Balague tok say wetin we dey see from Lamin na extraordinary tin wia e don change football around di world.

"Barcelona players bin dey look to am for solutions. Oda players bin feel say di time Inter don score 2-0, na only Yamal fit solve di problem."

Yamal fit match Messi im longevity?

Dat na hard question to answer.

"As tins stand and di record between im and Messi when dem start dia Barca career, Yamal bin dey ahead of Messi," Balague tok.

But to dey di top at 15 years and to dey play well well for every final you play, na sometin wia go need plenty consistency, luck and ogbonge mentality wen tins don dey scata."

"At dis moment, everytin dey go well well wia dis na di biggest impact Yamal don get – im dey make we rush to watch Barcelona, sake of we wan see am. Im dey make we comot our seats to shout when im do sometin."

Di youth coach dey remember when im watch Yamal decide cup finals, wia include im own "remontada" against Real Madrid. Now im dey do am on top ogbonge stage.

"Who dey expect pesin wey be 16,17 years to play for Barcelona first team wia im go dey control tins for di picth, like wetin im do v Inter Milan for di first leg semifinal or even wetin im do for di Euros?," Moral tok.

"Dis boy na pickin, but im dey unbelievable, I no sabi wia im carry dis talent for but we don dey watch one of di greatest players for di future, I dey sure."

"For me Messi na di best in history. But if everyone help Yamal – di environment, friends, family, coaches, sometimes injury – but if evritin go well, wia im take good decisions, I no wan tok say im go better pass Messi but im dey on di way.."

Start of new Barcelona dynasty?

Van Bommel tok say when Barcelona bin win di 2006 champions league, dat na di beginning of di Messi era – di time wia dem build di team around La Masia talent wit Messi for di front.

Now pipo don dey tink say Yamal fit lead di new batch of young stars into new era of success, wia nobody fit beat dem.

Dis na wetin Moral and odas wey bin coach for La Masia don dey hope for since since.

"We tok am say e neva go happun again. Now see, 10 years later, we don dey di same situation,"Moral bin explain as im remember say im watch Yamal, Gavi, Alejandro Balde and Pau Cubarsi; im say dia is more to come.

"When dis players touch di ball, you go feel sometin special as coach.

"Barcelona don dey do good tins – dem invest for La Masia, di players, di coaches and everibody, now na normal tin to see players like 16, 17, 18 years wey dey play for di senior team, unbelievable."

"When Xavi dey top level, na im be 26, 28 years. Dis pickins na 17, 18 years, make una just imagine wia dem go be in 10 years."

Barcelona go dey hope say when di curtain don come down for im career for Nou Camp, e go be legacy wey go reach di one Messi don leave.