Mexico president go carry man wey sexually harass her for street go court
- Author, Will Grant
- Role, Central America and Cuba correspondent
Mexico President Claudia Sheinbaum don tok say she go press charges against one man wey sexually harass her during her public appearance.
Mobile phone fotos of di incident on Tuesday show Sheinbaum as she dey tok to a group of supporters on di street near di National Palace in Mexico City.
In di video, one man approach her from behind and try to kiss her on di neck and place im hands on her body.
Sheinbaum sharpaly comot and member of her team step in, but she dey shake. Dem don arrest di offender.

Wia dis foto come from, Juan Abundis/ObturadorMX/Getty Images
"My view be say, if I no file complaint, wetin go happun to oda Mexican women? If dem fit do dis to di president, wetin go happun to all women in our kontri?" Sheinbaum tok dis for one news conference on Wednesday.
"I decide to press charges becos dis na sometin I don experience as a woman, but sometin wey women don experience in our kontri," she tok. "I don experience am bifor, wen I no be president, wen I be student."
She add say she don decide to press charges against di suspect as e don allegedly harass oda women in di crowd.
"A line must be drawn," she tok.
Women rights groups and feminist commentators don tok say di incident show di extent of ingrained machismo for Mexican society, wia man believe say e get di right to follow pesin tok even di president if she be woman.
Femicide na also huge problem for Mexico, wit staggering 98% of gender-based murders wey dey go unpunished.
Sheinbaum promise to tackle di issue as candidate, but so far in her administration no visible improvement in dat area of violent crime.
Dis incident also happun amid discussions about presidential security and di wider safety of politicians.
As president, Sheinbaum don broadly follow di approach of her predecessor, Andres Manuel Lopez Obrador, go get close and regular contact wit her supporters on di streets or in campaign events.
Dis event na security concern for her team. However, she confam in her new conference say she no get intention of changing her policy of interacting wit her supporters.
Di incident also happun just days afta di murder of Carlos Manzo, di mayor of Uruapan, one municipality in di violent state of Michoacan, at di local Day of di Dead celebrations.
Manzo don call on Sheinbaum for greater federal support for Uruapan in di fight against drug cartels.
Around 35 candidates die as di general election dey get close last year, na one of di bloodiest campaign in modern Mexico.
Since taking office, Sheinbaum don improve di kontri security situation, particularly clamping down on fentanyl-trafficking – one key issue for her US counterpart, President Trump.






