Trump approve Iran attack plan but neva make final decision - Reports tok

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Graeme Baker
- Role, BBC News
- Author, Helen Sullivan
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
United States President Donald Trump don approve plan to attack Iran, but e neva make final decision on weda to strike di kontri, BBC US partner CBS dey report.
President Trump don dey delay strikes in case Iran agree to abandon dia nuclear programme, na so one senior intelligence source tell CBS.
Tori be say Trump bin dey consider a US strike on Fordo, wey be Iran underground uranium enrichment facility.
Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei on Wednesday reject Trump demand for unconditional surrender, as US president say im patience dey run out.
On Wednesday, Trump say, "I fit do am, I fit no do am", wen dem ask am kwesion weda US go dey involve for Iran.

Wia dis foto come from, Reuters
Khamenei tell Trump on Wednesday for one recorded speech, say "any US military intervention" go dey costly and add say: "Iranian nation no go surrender."
Trump no send di response, im tell Khamenei "good luck", but again no gree to im plans. "I mean, nobody sabi wetin I go do," im tok.
"Unconditional surrender – dat one mean say I don get enof."
Tori pipo Wall Street Journal na dem first report say Trump dey support strike plans.
Israel military say dem launch more more attacks on Iran, hitting missile sites and nuclear facilities.
Iran say dem bin fire hypersonic missiles in response.
Dis na Khamenei first appearance since Israel launch im unprovoked strikes on Friday.
Iran mission to United Nations mock Trump for posts on X: "Iran NO DEY negotiate under duress, NO GO accept peace under duress, and certainly NOT wit has-been warmonger wey dey cling to relevance.
"No Iranian official don ever ask to grovel for gates of White House," e add.
"Di only tin more despicable dan im lies na im cowardly threat to 'take out' Iran supreme leader."
Di war of words dey come as Iran pipo kontinu to jam roads out of di capital Tehran, city of 10 million pipo. And Israel pipo for Tel Aviv dey hide inside underground bunkers, as di civilians dey find sanctuary attacks.
Benjamin Netanyahu, Israel prime minister, tok for one video on Wednesday say im kontri forces dey "progressing step by step" towards eliminating threats wey Iran nuclear sites and ballistic missile arsenal dey cauuse.
"We control di skies over Tehran. We dey strike wit tremendous force on di regime of di Ayatollahs. We dey hit nuclear sites, di missiles, di headquarters, di symbols of the regime," he said.
Pete Hegseth, Trump defence secretary, tell Senate committee say Pentagon dey ready to execute any order wey Trump give.
In tok dis one as American forces dey build-up for Middle East.
One carrier strike group wey USS Nimitz aircraft carrier dey lead bin dey steam from south-east Asia to join anoda strike group wey USS Carl Vinson dey lead, wey already dey di Gulf.
Various air assets including refuelling tankers bin also dey on flight trackers moving from Europe, with reports of F-22 and F-35 strike aircraft following.
US State Department said Secretary of State Marco Rubio go meet UK Foreign Secretary David Lammy for Washington DC on Thursday, for tok tok wey dem expect say go focus on Iran.
BBC understand say, so far, US never make any formal request to use UK military bases for Diego Garcia or Cyprus to conduct strikes against Iran.
Normally, US go first inform dia ally of dia plan to conduct offensive operations from those bases.
One British source say dem believe say "all options" dey on di table for Washington but e no get any complete picture of wetin America get for mind.
US embassy for Jerusalem on Wednesday issue evacuation plan for American citizens wey currently dey Israel.
E no clear how many Americans wan leave Israel or weda US military go assist wit evacuation flights.
Since wey e begin attack Iran on Friday, Israel strike for Iran don kill 585 pipo, according to Washington DC-based group Human Rights Activists, wey say 239 na civilians, including women and children and 126 na security personnel.
For dia revenge, Iran don fire around 400 missiles enta Israel, killing 24 pipo, all of dem civilians, according to Israeli authorities.
Meanwhile, Iran state TV don warn pipo wey dey watch dem make dem ignore "irrelevant" videos wey dey call for di public to "rise up" against di regime, afta one hack of im satellite feed.
"If you notice irrelevant messages as you dey watch TV, na sake of say di enemy dey jam satellite signals," state TV tok.
Hackers bin break in and broadcast one video wey accuse Iran establishment of "failing" im own pipo, call on viewers to "take control of your future".
E show several videos of mass protests against di regime for 2022.











