You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Barbaric' video wey show landlord dey beat naked wife for public draw outrage for Ghana
Di Police for Ghana dey under pressure to prosecute one landlord wey beat im naked wife for one compound house inside viral video.
Many pipo vex afta di video begin to trend on Monday.
Inside di video, di landlord John Odartey Lamptey dey beat im naked wife on di floor even though she dey cry and beg di man.
One tenant for di compound house film di attack wey she tok say di landlord dey beat im wife everyday for di house.
Many pipo share di video wey dem call on di police to find di man and arrest him sake of pipo wey dey stay for di compound house dey at risk.
TV presenter Desmond Okraku Danso say "dis be difficult to share but di police for find dis man. Dis be absolutely disgusting," he write for social media.
Anoda pesin say "di police for use dis man do example and punish him proper. Di law gatz to work for dis mata."
"If only di police go do dia job and prosecute dis case well well, he fit go jail wey odas go learn," Kennedy Essuman tok.
Lawmaker and MP for Buem Fred Agbenyo tok for local network TV3 say "dis be unacceptable. Di law gatz to deal wit dis mata."
Gender ministry describe di incident as barbaric
Hours afta di video spread for social media, di kontri ministry of gender and social protection release one statement wia dem condemn di act.
Di minister say "nobody get di right to abuse any pesin under any circumstances."
"We condemn dis barbaric act in di strongest terms – di sector minister inform di police to investigate di mata to ensure say di woman get justice," di ministry add.
Dem also ask witnesses and oda tenants wey see wetin happun, to provide information to di police wey go help di investigation.
Di ministry say dem go collaborate wit di security agencies to ensure say pipo wey engage for domestic violence go face di law.
Police arrest landlord and two oda relatives
Hours afta pipo alert di police about di viral video, di service inside one statement confam say dem arrest di landlord.
According to di police, dia CID department arrets di suspect for dia house wey dey Ofankor for di Ga East municipality.
Di statement tok say "afta we arrest di man, we also arrest two of his relatives."
"Grace Lamptey and Louis Lamptey wey be di siblings of di suspect try to attack di female tenant wey film di video of di abuse, so we arrest dem also. We also rescue di lady tenant wey film di video for her safety," di police CID statement wey Chief Inspector Brigitte Babanawo don sign.
Many pipo dey concerned about di wife wey suffer di abuse inside di viral video.
Police say dem dey try to find her to ensure her safety afta she comot di house bifor police arrive there.
"Di police dey committed to protecting victims of domestic violence wey we dey ensure say pipo wey do dis kind tin face di law."
Di police go soon charge di suspects for court.
Many pipo say dem dey follow dis mata to see how e go end.
On top social media, pipo believe say di only way dis go make sense, be for di court to jail di suspect.
Women's right advocate and lawyer Marian Darlington tok say di gender minister and oda agencies gatz to protect woman and her children afta dis arrest.
"Di woman go suffer trauma for long as she dey endure dis abuse for long from wetin di tenant wey film di incident explain. Dis be her reality but di state gatz to do sometin about dis mata."
Lawyer Darlington tok for TV3 say "our society make dis kind tin common; sake of even abusers fit pursue victims even afta dem comot di abusive environment to harm dem, so we gatz to protect dis woman and her children."
She say di police gatz to "prosecute di mata wey pipo fit take up di civil aspect of di case even as di gender ministry and social welfare provide therapy for di woman and her children."
For Ghana if dem find pesin guilty of assault and domestic violence, di pesin fit spend up to 10 years for jail.
Depending on di level of di offense, di pesin fit pay fine or enta prison.
Di court go also issue wetin dem call protection order wey go prevent di offender from committing further acts of violence or entering di victim's house or workplace.