Amazon Internet services down, who dey affected

Big screen wey dem write AWS put wit phone for front of am wia em write Amazon

Wia dis foto come from, Algi Febri Sugita/SOPA Images/LightRocket via Getty Images

Read am in 3 mins

Snapchat, Canva, Duolingo and many of di biggest websites and apps for world don red as Amazon Web Services don take dia light.

Amazon Web Services (AWS) na Amazon cloud computing division and dia infrastrictiure na im dey hold up millions of large companies dia websites and platforms.

Oda apps wey suffer from wetin dey do AWS na Roblox, Fortnight, Zoom, Signal among plenti more.

Di AWS for update for dia status page say engineers don dey handle di mata and find wetin cause am. Dem sat dem find "increased error rates and latencies for plenti AWS Serivices for di US-EAST-1-Region."

Dem respond later say dem don find di root cause to di wahala and say, "we dey wrk on multiple parallel paths to make di recovery happun fast-fast".

But no be only apps feel di sting as customers don dey hala for several banks wey dey use AWS too.

Even wit di level of errors wey dey come sake of dis mata, pipo fit dey use di applications normally.

Dis na di apps and sites wey dey affected according to Downdetector wey be site wia pipo dey go to report damages.

  • Snapchat
  • Zoom
  • Roblox
  • Clash Royale
  • My Fitness Pal
  • Life360
  • Clash of Clans
  • Fortnite
  • Canva
  • Wordle
  • Signal
  • Coinbase
  • Duolingo
  • Slack
  • Smartsheet
  • PokemonGo
  • Epic Games
  • PlayStation Network
  • Peloton
  • Rocket League
  • UK tax authority HMRC

Dis no be di full list of sites wey dey suffer from AWS outage.

According to di Downdetector site, na ova 500 companies dey face issues and di number of reports dem get worldwide reach four million reports.

But di koko be say, dis outage no affect all di applications wey pipo dey use.

Google serivces for example get dia own cloud computing wey dem ey use and e be like everytin dey go smooth.

Oda reasons while some sites no dey affected be say dem fit get different cloud providers or services in case one of dem start to get k-leg as dey happun now wit AWS.

Meta platforms like Facebook and Instagram wey face dia own outage for 2021 look like say dem dey work normal.

Elon Musk don also reveal say X dey go as e dey go witout wahala.

Web outages don dey turn normal tin?

Outages wey dey affect web platforms and services no dey new.

E no really get week wey go pass witout say sometin off wey pipo need for vital web services weda na WiFi or na internet banking.

But for multiple sites to just off from one outage no dey as comot. But sabi pipo tok say e dey happun more and more bicos many of dis platforms dem dey use di same provider for dia serivices.

AWS na huge provider for cloud computing wey mean say if anytin sup wit am, e fit cause gbege for di many sites wey dey rely on am.

BBC technologia tori pesin, Live McMahon tok say "bifor we don see different types of providers like di content delivery network wey dem dey call Fastly as dem dey off plenti services at once."