You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Julius Malema react afta Trump ask Ramaphosa why e neva arrest am
Economic Freedom Fighters (EFF) leader Julius Malema don react to di meeting between US President Donald Trump and South African President Cyril Ramaphosa wey happun for US on Wednesday 21 May.
Malema say na im be di centre of attraction for di meeting, wia Donald Trump bin ask Ramaphosa why e neva arrest di EFF leader for im chant, "Kill the boer, kill di farmer".
Donald Trump bin raise di issue of farm murders and di taking ova of lands from white South Africans and ask im pipo to play video clips from various addresses by Malema wia e dey make di chant.
Ramaphosa no dey comfortable wen dem play dis video and e ask im Minister of Agriculture John Steenhuisen to help am respond to one question about farm killings.
Billionaire businessman Johan Rupert wey also dey di meeting say, "I don be target of dis man for ten years."
Afta di meeting, Malema write on im X page, "A group of older men gada for Washington to gossip about me. No significant amount of intelligence evidence don dey produced about white genocide. We no go agree to compromise our political principles on land expropriation without compensation for political expediency."
Dis meeting for di White House dey come afta Ramaphosa bin call di group of 59 white South Africans wey gree to be refugees for US, cowards.
Trump say white farmers dey "run from South Africa".
End of Di one wey oda users dey read well well
Di US president and im padi, South African-born Elon Musk, don tok bifor say "genocide" of white farmers dey go on for im kontri of birth. Dis na claim wey dey widely discredited.
Trade also dey part of wetin dem tok about as South Africa bin gbab 30% tariffs from di US.
EFF react to Trump and Ramaphosa meeting
Di Economic Freedom Fighters (EFF) wey be di party of Malema don also react to di meeting between US President Trump and South African President Ramaphosa.
EFF react through dia statement for X, wia dem say dem no like wetin happun for di meeting.
Di party say di meeting wey dem suppose discuss diplomatic, trade and economic relations, na discussion of dia party leader Julius Malema and "im principled position" regarding di return of di land to African pipo na im dem tok.
Malema party say dem no dey surprised to see say di delegation wey follow Ramaphosa go US na di likes of "Stellenbosch racist billionaire Johann Rupert, Donald Trump golfing buddy Erie Els, and Minister of Agriculture and leader of di racist Democratic Alliance (DA) John Steenhuisen."
"Na interaction wey dey dominated by white privileged men, wey don gain wealth at di expense of African pipo."
EFF mention how Trump bin play 'numerous clips of di President of di EFF' wia e dey speak and sing about di unequal distribution of land for South Africa.
"Di chant "Kill The Boer, Kill The Farmer", na song wey dey express di desire to destroy di system of white minority control ova di resources of South Africa," EFF tok for statement.
Meanwhile, for 2010, dem bin put Malema on trial for singing di song.
Dem bin declare di song as hate speech, but High Court for Johannesburg bin later rule say di song no be hate speech or e no dey provoke pipo to violence.
EFF add say South Africa dey embarrassed by di delegation wey dey contradict diasef, but dey happy say dia legislative and political agenda by Malema dey shake "corridors of imperialism for US".
"Our Commander in Chief dey considered as great revolutionaries, as Donald Trump for im illiterate rants don call for im arrest for daring to call for land expropriation without compensation."
"As a result, di EFF dey worried by dis call say somtin gatz need to be done to stop di EFF President from chanting a liberation heritage song. We go oppose any compromising of our laws to allow for Starlink to operate for South Africa," EFF tok for dia statement.
Malema and im party say dem go defend dia "constitutional democracy and neva bow to imperialism".