Suspected killer of Kwara student Yetunde Lawal narrate wetin happun bifor her death

Read am in 3 mins

Di trial of one Abdurahman Bello and four odas wey chop accuse for di murder of 23-year-old female students of Kwara State College of Education for Ilorin, Nigeria, bin take place today on Wednesday 21 May.

Today for Kwara State High Court, dem bring evidence wey include two hands, one table, one machete, one axe, phones, one knife and one rubber band wey dey stained wit blood.

Di case of Yetunde Lawal bin happun for February 2025, wen police say dem receive report of a case of murder and rape against against one man, wey dem identify as Abdurahman Bello.

Police inspector Ayodele Azeez of di Kwara State Police Command Criminal Investigation Department tok say during investigations, dem go di house of Bello and dem find some items for dia.

Among di items wey dem find for im house na Yetunde earrings, shoes, documents, and phone.

Di Police inspector wey serve as first witness for di case tok say for dia investigation, dem take di statement of di accused wit knowledge of im lawyers, and e sign di statement. Di court admit di statement as evidence for di case.

Dem present di evidence for court today wey include audio and video footage of di accused.

For di statement, di accused tok say e and Yetunde bin meet online and dem begin tok love and marriage mata.

"Hasfot (Yetunde) don promise me for long say she go come my house."

Di accused say di day wey di incident happun, di deceased come im house and wen she dey hungry e buy food give her.

Na afta di food dem kon make love and she bin faint, di accused tok.

"Na becos say I no fit carry her deadi bodi, na im make me bury her body for grave and cut off her two hands to make money."

How dis mata take start

For February 2025, police for Kwara State, southwest Nigeria, bin confam say dem arrest one 29-year-old man wey allegedly kill and pieces di body of one 23-year-old female student of Kwara State College of Education, Ilorin.

Tok-tok pesin for di state police, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, tell BBC News Pidgin say di name of di victim na Yetunde Lawal, say dem don begin investigation to know wetin really happun wey lead to di murder.

According to di tok-tok pesin, dem first receive alert of missing pesin from di victim papa.

According to dem, security personnel find di dismembered bodi of Yetunde inside bowl for di suspect house.

Tori for town be say dem both meet online and begin friend till di suspect invite her over.

Police say di lady bin don dey miss since 10th February. Na four days later dem find her bodi for di suspect house.

Late Yetunde na di first pikin of her family. Her papa and mama still dey alive. She bin dey final year for Kwara State College of Education, Ilorin, bifor di incident happun.