Two years afta im death, family reveal burial arrangement for Sylvester Oromoni of Dowen College

Sylvester Oromoni

Wia dis foto come from, BBC/Sylvester Oromoni

Two years afa di death of 12-year-old Sylvester Oromi, im family don announce burial plans for di pikin.

Im tori burst for November 2021 say Sylvester die for Dowen College afta some seniors bin bully am as dem bin allegedly try to make am join cult.

For statement from di family of di pikin, dem reveal say im burial go hold on Saturday 27 of January for Delta State.

Dem further reveal say even wit all di media attention wey di mata bin get, di family neva get any justice on di mata.

Di statement describe di boy as veri intelligent and mature. E bin apparently get passion for computer science, programming electrical science and football.

Tori be say im papa bin declare say dem no go bury im pikin till im get justice for am.

Na for di later part of 2021 wey wan video bin go round for social media wey show one pikin dey cry of pain.

Di video bin comot from Dowen College, one boarding school for di Lekki area of Lagos State.

Di student, Sylvester Oromoni, die just few days to im 12th birthday and na wia di social media user wey post about am reveal for im X say, "dis na my cousin wey dem beat to death for one school wey cost ova one million naira.".

At di time na more dan 180,000 pipo sign petition dey demand justice afta di death of Sylvester.

Wetin don comot from di Lagos inquest on im death

Lagos State goment set up di coroner inquest to find out wetin really kill di young boy.

On 14 March 2022, Doctor Clement wey dey work for Central hospital Warri, Delta State during di inquest say if to say na im handle di case dat time [wey im dey sick], e for do blood transfusion as last test result on di boy on November 30 show say im bin dey clinically ill and need close monitoring.

E use di opportunity to defend im original statement wey say na chemical intoxication cause di death, e say im give dat statement before di toxicology result rule out di first statement.

Dr Clement say im December 30 final autopsy report show say na pneumonia due to severe sepsis kill di young boy.

According to am, na for 2nd December 2021 police send am notice to come do autopsy on di deceased. By di end of di second week of December di results don ready, according to am.

Wetin we call dis Video, Sylvester Oromoni papa tok how im pikin die

As at wen e finish di autopsy, im say e no see anytin wey show why di young boy die. Di doctor say im also notice acute lungs injury for im bodi.

“I collect sample from di urinary bladder, blood from di heart, di lungs, di eye, di tongue and di liver sake of say if anytin pass through di mouth e go pass through di liver” na wetin Doctor Clement tok.

Police later call say di boy papa don report di mata for Lagos command and oda parties go need dey involved for di autopsy.

Di next pathologist come to Warri say dem go carry di bodi down to Lagos. Na so dem move di body to Lagos for second autopsy.

During cross examination, di magistrate Mikhail Kadiri ask am say “before you start to open di bodi, you see any trace of beating or trauma on di bodi”?

Di doctor wey be di 12th witness to come give evidence before di coroner answer “no, I only notice bruising for di lips, I no even see evidence of significant bleeding or blunt forced trauma”.

Dr Clement add say dem tell am say pipo beat di deceased but dem no tell am say dem give am substance to drink. Say na di papa supply information say di boy drink one kain substance.

Di doctor add say: “Wen I look im bodi, I no see any open injury, I suppose see evidence of bleeding for im abdominal cavity, but wen I open im cavities I no see anytin like beating”.

Lawyer to di Oromoni family Femi Falana ask di doctor during cross examination weda di boy fit don collect bruises before, di doctor say e dey possible, but add say im no see any ankle injury on di deceased as di second autopsy report from Lagos tok.

Wen di court ask am if e bin dey possible to cure di boy, di doctor reply say “apart from say I be pathologist, I be pastor too.

"I sabi pipo wey bin don collect best of care, but still di."