ICJ say Israel must prevent genocide in Gaza

ICJ Judges

Wia dis foto come from, EPA

UN top court order Israel to take measures to prevent and punish direct incitement of genocide for dia war in Gaza, Reuters report.

"Di state of Israel gatz.... take all measures within dia power to stop di commission of all acts within di scope of Article II of di Genocide convention," di court tok.

For one major ruling, a large majority of di 17-judge panel of di ICJ vote for urgent measures wey cover most of wetin South Africa ask for – and e dey notable say di court no order Israel to stop dia military action for Gaza.

ICJ president Judge Donoghue say South Africa get legal standing to bring case against Israel for wetin dem dey do far Gaza.

Israel no fit object to South Africa standing, Presiding Judge Joan Donoghue tok - adding say any party to di Genocide Convention fit bring case against anoda state.

South Africa get standing to submit di dispute wit Israel concerning alleged violations of obligations under di convention, she tok.

Court order 'no dey work' witout ceasefire - South Africa

Di foreign minister for South Africa, Naledi Pandor, don react to di ICJ ruling. She bin speak to reporters outside di court wia she express di position of her kontri.

Pandor tok say if Gaza no ceasefire, e mean say di ‘order no dey actually work.’

“I go don want say make dem include di word stop for di judgement but I dey satisfied wit di directions wey dem don give,” she say.

Di minister add say she no too dey hopeful say Israel go obey di court order.

South African goment for di statement tok say di ICJ judgement na "landmark ruling".

“South Africa dey sincerely hope say Israel no go act to frustrate di application of dis Order, as dem bin publicly threaten to do, but make dem act to comply wit am fully as e suppose be.”

South Africa tok say dem go dey preserve Palestinians pipo.

“South Africa go continue to do evritin within im power to preserve di existence of di Palestinian pipo as a group to end all acts of genocide against dem and to walk wit dem make dem achieve dia right to self-determination.”

ICJ

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Israel no fit object to South Africa standing

Di provisional measures wey di court issue

Some of di provisional measures wey di court make include:

  • Israel gatz take all measures to prevent any acts wey fit dey considered as genocidal - killing members of a group, causing bodily harm, inflicting conditions wey fit bring about di destruction of a group or preventing births
  • Israel gatz ensure say dia military no commit any genocidal acts
  • Israel gatz prevent and punish any public comments wey fit dey considered as incitement to commit genocide for Gaza
  • Israel gatz take measures to ensure humanitarian access
  • Israel gatz prevent any destruction of evidence wey fit help for di genocide case
  • Israel gatz submit a report to di court within one month of dis order wey dem give

Di court dey also express serious concern about di fate of hostages wey Hamas don hold and dem call for dia immediate release.

Di court no totally agree wit South Africa request say make Gaza ceasefire, but di majority of di 17 judges ruled say make Israel do everitin within it power to avoid killing Palestinians.

Among di oda measures for di ruling na make Israel no try impose measures wey go prevent Palestinian women from giving birth and make dem no cause serious bodily or mental harm.

Dis no be di final ruling ontop genocide sake of say e fit still take several years. But di measures wey di court give na to make sure say while di judges consider South Africa fundamental charge against Israel, make Palestinians for Gaza enjoy some protection.

Israel go decide how to respond as di ICJ ruling dey binding but enforcement mechanism no dey.

Israel fit decide to ignore di judges altogether but diplomatic efforts dey go on within two months to possible ceasefire and improve flow of aid into di Gaza strip.