Stevie tok about di Wonder of becoming a Ghanaian citizen

Wia dis foto come from, The Ghanaian Ministry of Interior
- Author, Thomas Naadi
- Role, BBC News, Accra
Dem born di superstar wia dem raise am for Michigan but im get long love for Ghana - a west African kontri wey dey thousands of miles away from home.
For 1975, Wonder openly tok say im want to quit music and move to Ghana afta plenti hit albums.
Im believe say im fit to trace im ancestral lineage to Ghana, according to tori.
Wonder continue to dey sing but afta im headline one Ghana music festival inside di 1990s, im don tok again say im wan set up im home for dia.
Later, di musician write im album Conversation Peace, as im tok for anoda interview three years ago say im dey move to Ghana to escape racial injustice for di US.
Wonder im love affair wit di country don increase by di pipo im meet as im dey dia.
Im tok di BBC say one of dis encounter na wit di late Ghana president Jerry Rawlings, wey host am for di presidential residence in di 1990s.
"I remember di late president Rawlings wey allow me to be co-pilot inside one flight", Wonder tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I fly wit am from one end of Ghana to di oda end. Di north to di south wey e dey amazing."

Wia dis foto come from, Ghanaian Ministry of Interior
Wit im family and di scarf wey im dey wear, made of kente cloth, Wonder dey happy say im finally become Ghanaian.
Ghana don dey describe demserf as di bastion of pan-Africanism - dia founding leader, Kwame Nkrumah call di west African sate as "Black Mecca".
Wonder na di latest African-American icon wey celebrate dis message - W E B Du Bois don move to Ghana wey dem bury am dia in 1963, while Martin Luther King, Malcom X and Muhammed Ali all visit di kontri to reconnect wit dia African roots.
For 2001, Ghana become di first kontri on di continent to give di descendants di right to stay for dia.
Since den, Africans wey dey di diaspora don go Ghana to live and work without renewing dia visas or work permits.
In 2019, di Ghana goment launch di "year of return" initiative to encourage Africans for di diaspora to relocate dia.
More dan 300 Africans for di diaspora don get Ghanaian citizenship since den.
Inside one statement, interior ministry for Ghana tok say dis move by Wonder dey "mark ogbonge tin for di kontri im effort to attract Africa pipo wey dey di diaspora and to recognise dia contributions".
Di man imserf tok say im now get plans to engage in tins wey go create job for di kontri youth wey be like 38 percent of di population.
"Di youngest generation dey inside Africa. We gatz to tink about how dem go fit ti shine," im tok.














