Mama Toli Toli di market woman wey capture di hearts of pipo wit comic singing and dancing for Ghana

Wetin we call dis Video, Meet di market woman wey turn internet sensation
Mama Toli Toli di market woman wey capture di hearts of pipo wit comic singing and dancing for Ghana
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Ghana

Mama Toli Toli be pesin wey don dey sell smoked fish for one market for Ghana capital, Accra.

But now, she don become social media sensation wey dey spread happiness thru comic singing and dancing.

Whenever you turn on your phone, na so you go see Mama Toli Toli and oda market women for Makola wey dey trend for TikTok, Instagram den Facebook.

Now, im don make popular.

“Since I don become popular, many pipo don dey come dis market to find me,” mama Toli tok BBC Pidgin.

“Some come to buy fish, odas come to motivate me say make I continue to dey entertain dem.”

Mama Toli Toli

How im begin to dey dance and sing

Bifor, wetin Mama Toli Toli sabi be say make im go di Makola market evriday to sell im smoked fish.

Na so one man im name na ‘Official Starter’, don carry di singing and dancing idea comot.

Official Starter na dancer for di DWP academy for Ghana, wia im say im “find im purpose wey be to dey dance.”

“Na my mama wey inspire me. As im die for 2020, I don get energy say make I begin somtin to make market women happy becos na im too na market woman,” Official Starter don tok BBC pidgin.

Na so “I take start di happy town project wey dey sweet pipo for social media well well.”

For dis project like dis, we just dey “happy oursefs as we dey do our normal work.”

One day, na mama Toli Toli tok say im wan sing one song wey sweet am well well for radio.

Despite say im neva sabi di lyrics of di song, Mama Toli Toli sing di song, like how im dey hear am inside radio.

Dis na Asake im song, “lonely for di top”.

Afta dis video reach di internet, pipo now begin to dey call am “Mama Toli Toli”.

“My real name na Comfort Kotei but evribodi sabi me as Mama Toli Toli. Na me be di pesin wia don dey sing and dance for TikTok and Instagram.

Mama Toli and oda women wia dem don dey sell for di Makola market dey happy diasef by dancing to all dis Ghana and Nigeria songs.

Afta, dem go put for social media.

Mama Toli Toli

Pipo don react to Mama Toli Toli and im friends

For October 2023, Nigeria super star Burna Boy don put up billboard for di Makola market wia Mama Toli Toli and im friends don dey sell dia fish and oda tins.

Dis na afta im see how dancer, ‘Official Starter’ and di market women don dance to im song ‘City boy’.

For dat viral video, di women don jump onto di song wia dem dance.

Burna boy don decide say im go appreciate di women wit one ogbonge billboard for di entrance of dia market for Accra.

Today today, dat billboard still dey di market wey im dey remind dis women say pipo dey sabi dia work wia dey bring pipo joy.

Mama Toli Toli tok say, dat na good tin for im friends and im family.

Mama Toli and im group don dey play shows

Mama Toli Toli

Since dat Burna boy video, dis market women don dey get invite say make dem come perform for ogbonge programmes.

Mama Toli tok say di first time im play dat kind show, na im dey shy well well.

“I neva stand in front of crowd like dat bifor. Dat day, I don shy well well. But as pipo don tok say dem enjoy our entertainment, I neva dey shy again.”

“Now I dey perform inside big crowd,” Mama Toli Toli tok BBC Pidgin.

For December last year, Mama Toli Toli and di market women don perform for di MTN festival of nine lessons and carols.

Na so di crowd don happy to see Mama Toli Toli and di market women for stage.

Na only last week, dem also perform for anoda ogbonge event for Accra.

Mama Toli say dis tin don change im life.

“Since I don become popular my family, my husband and my pikin dey proud of me. Oda pipo too sabi say I dey try.”

Mama Toli Toli don turn star for di Makola market

Now, everibodi for di market sabi Mama Toli Toli.

Im customers wia come dey buy smoked fish for im side also sabi say dia customer na social media star.

Some of dem don dey give am gift and oda tins to motivate am to do more.

“I dey here so, plenti of my customers come dey find me evriday. Some fit tok say make I take dis moni to buy data to post more videos for social media, make pipo dia stress and BP come down.”

“For di fish business, na my first business so I dey like am well well. Now my fish dey sell fast. Evribodi dey look for Mama Toli Toli to buy im fish. All dis na Baba God do am,” Mama Toli add.

Wetin make pipo like im mata

Mama Toli Toli tok say wetin im tink say make am popular na how im dey sing di songs wia im neva know di lyrics.

“Di songs na English, I neva sabi speak English but di Ghana and Nigeria songs don dey sweet me well well.”

Mama Toli also know say im get support for Nigeria.

“Pipo don tok me say pipo for Nigeria dey like wetin I dey do. I wan enta dia to meet some of di musicians wia I go sing dia songs and make dem happy also.”

Dis na di happy town project, wia mama Toli Toli say im dey hope to spread di happiness and joy to Nigeria.

To meet Davido, Burna Boy, Asake and odas na im dream!

Video by Monday Idara