'She dey emotional and scared' - Support for Comfort Bob inside Ibom Air incident increase as NBA chook mouth

Wia dis foto come from, Afam Osigwe/X, screenshot
- Author, Anntte Arotiba
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 5 mins
One of Comfort Emmanson - Comfort Bob legal representatives Funke Treasure don confam to BBC News Pidgin say court don grant her bail and dem dey try perfect di bail paper works, so dat she go fit go house.
Authorities for Nigeria bin charge Bob wey chop accuse say she assault airline officials on top Ibom Air Flight go court and she dey custody for Kirikiri Correctional Centre for Lagos.
Aviation Minister Festus Keyamo confam am for statement for im X account say dem charge Emmanson also known as Comfort Bob on five counts of criminal charges including assault and as she no fit provide sureties, dem remand her for prison.
Di Ikeja Magistrate Court adjourn di case against Bob to 3 October, and dem bin remand her for Kirikiri Custodial Centre for her to perfect her bail.
However, her lawyer say dem no go allow her remain for Kirikiri till den as dem go ensure to perfect her bail conditions.
Ms Treasure add say di Kirikiri prison bin limit di number of pipo wey fit see her, but her lawyers follow her tok on phone, but she dey "emotional and e be like say she dey scared."
For one post on her Facebook page, Treasure say pipo wey stand as sureties for her go soon show for interview and dem go carry out her bail verification exercise, so dat she go fit comot dis week. "She no fit remain dia till di next adjourned date."
"We go ensure say she meet her bail conditions ASAP and take up di issue wit di airline." She tok for di post.
Di lawyer add say di airline get plenty questions to answer sake of di high level of inhumane and degrading treatment dem subject di passenger to.
Meanwhile, di Nigerian Bar Association (NBA) don call on Ibom Air to immediately withdraw di life-time ban dem sama on female Ms Comfort Emmanson - Comfort Bob.
Di NBA President Afam Osigwe, SAN, wey make dis demand for one statement e issue on Tuesday 12 August, tok say di decision to impose lifetime ban on Ms Emmanson without fair opportunity to hear her own side of di tori dey illegal.
"Ibom Air so far don only present dia own version of events without giving her di chance to respond. Dis one-sided process, wey add to di ban by di AON, go against di fundamental principle of fair hearing and e render di decision legally and morally indefensible."
Di president for di NBA for di statement tok say di power to suspend or restrict any passenger right to fly rest wit di appropriate statutory regulator, no be private associations or airline operators wey dey act alone.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di NBA reaction dey come afta one video show how airport securities take comot Ms Emmanson from one Ibom Airline flight on Sunday, 10 August after dem accuse her of unruly behaviour for di flight and for di airport.
Di video show as dem take drag her out of di airplane for way, wey di NBA and some Nigerians find offensive and against her human right.
Ibom Air and di Airline Operators of Nigeria (AON) bin impose life time ban on her. Police also charge her to court on five count charges wey include assault.
Currently, she dey remanded for Kirikiri maximum correctional centre for Lagos state as she dey seek to perfect her bail..
NBA wey strongly condemn di way di airline authorities take treat Ms Emmanson plus di sanctions wey dem sama her say make di airline issue public apology to her and cooperate fully wit impartial investigation into di incident.
Dem add say dem ready to provide her wit pro bono legal support to ensure say her rights dey protected and she get redress for di violations she suffer.
"E dey deeply disturbing say dem forcefully remove Ms. Emmanson from di aircraft, dem strip her of her clothing for public, and subject her to humiliation wey dem feem and spread online."
Di statement add say no pesin regardless of di circumstances, suppose dey treated in such a dehumanising manner.
"We no go remain silent while di fundamental rights of any Nigerian dey trampled upon, whether by public authorities, private corporations, or individuals. Respect for human dignity and di rule of law must never be compromised, and for dis mata, justice must prevail." NBA tok for statement.

Wia dis foto come from, Ibom Airline/X
NBA highlights laws wey dem break for di incident
Ibom Air and di Airline Operators of Nigeria (AON) no get right to impose lifetime flight ban on Ms Emmerson, as di tori na one sided and dem neva hear from di passenger, and dat breach di fundamental principle of fair hearing and e render di decision legally and morally indefensible.
Sake of dat, di association say make appropriate authorities carry out independent and impartial investigation bifor dem take any disciplinary action against di passenger.
Also, di photographing, dissemination, and online circulation of indecent images of Ms. Emmanson na big invasion of privacy and na criminal act.
NBA argue say dem suppose blur or edit di videos wey expose her nudity to di public.
Dem say authorities must identify and prosecute those wey dey responsible for capturing and distributing di unedited footage.
"Such acts destroy public trust and undermine di rights of all citizens to be treated wit dignity and respect," NBA add.









