You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Traders count dia loss as fire destroy Kantamanto market for Ghana
Fire outbreak happun for Kantamanto market for Accra, Ghana, for di early hours of Thursday, and destroy ova 100 shops.
Di fire wey start around 1:00 am don cause traders ogbonge losses.
One video wey di Ghana National Fire Service (GNFS) share on dia Facebook page show how dem dey quench di fire.
Dem quickly call di Electricity Company of Ghana (ECG) to cut power supply to di area, to ensure di safety of di operation.
Fire tenders from Circle, Trade Fair, and Dansoman arrive di scene of di fire.
GNFS say dem deploy 13 fire tenders from across di Greater Accra Region to combat di fire.
Di GNFS neva confam di cause of di fire, but investigations dey expected to commence once di area dey secure.
According to local media, no be di first time di Kantamanto market dey catch fire.
Many traders wey dey affected don ask for goment assistance to help dem get back on dia feet.
Pipo still dey waka round di market to see wetin dem fit pick from di remains of wetin burn.
Dennis wey be sales boy for di area tok say wetin e want na say make dem no use wood to build di market like dis but make dem use wetin dey durable to fire so dat if dis kain burning happun again, e no go burn di market finish.
E tok say, "as di market don burn like dis, I don enta ground zero bicos no be like say normally market dey go very well and work no dey."
Di fire service PRO, Divisional officer (DO) II Desmond Ackah reveal say no casualty bin dey recorded.
As at now, e say di fire dey under control.