Gunmen kill nine pipo for South Africa bar attack

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Jaroslav Lukiv
- Read am in 4 mins
South African police tok say dem dey look for suspects afta one shooting wey happun for one bar wia dem kill nine pipo and wunjure 10 for one neighbourhood wey dey gold-mining area near Johannesburg.
Dem tok say about 12 unidentified gunmen arrive for two vehicles in Bekkersdal, "open fire at tavern patrons and continue to dey shoot randomly as dem run comot di scene."
Di shooting happun around 01:00 local time for Sunday (23:00 GMT Saturday). Police tok say di tavern get license.
"Gauteng Serious and Violent Crime Investigations togeda wit Crime Detection Tracing Unit don launched manhunt for di suspects wey dey involve in multiple shooting incident wey happun early mor-mor for Bekkersdal on Sunday, 21 December 2025," according to SA police.
"Na nine pipo don die and 10 pipo injure from di shooting,"
"Di incident happun just bifor 01:00, at di Tambo section. Report say about 12 unknown suspects for white kombi and a silver sedan open fire at tavern patrons and continued to shoot randomly as dem run commot form di scene."
South Africa get one of di highest murder rate for di world. On di average from April to September dis year, sixty-three pipo dey die every day, according to police figures.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Pipo dey die of murder becos of arguments, robberies and gang violence, but why dem kill dem no dey clear.
At di scene, deputy provincial police commissioner Maj-Gen Fred Kekana tell Newzroom Afrika say di perpetrators, wey get pistols and one AK-47, dey shoot "unprovoked".
"Di poor patrons dey enjoy demselves wen pipo come and shoot dem."
Two of di victims dem shoot dem outside di tavern as dem dey try run away, and di third na taxi driver wey just drop passenger nearby, Maj-Gen Kekana tok.
One of di resident wey tok to Newzroom Afrika explain how gunfire don become normal tin for night for Bekkersdal.
"Criminals, dem dey wetin dem wan do for here. Dis guns, e dey sound every evening... as soon as night don show we know say gunshot go soon start and e go loud well well... E dey scatter our communities," di man tell tori pipo.
Earlier dis month, at least 11 pipo- including one child - die from gun shot for one hostel near Pretoria.
For anoda incident , 18 pipo die for rural homestead for Eastern Cape province for September 2024.
Di Bekkersdal attack happun amid high gun violence for South Africa, wia mass shooting don dey common.
South Africa get about three million legal guns, but at least di same number of unlicensed guns dey for di country, according to Gideon Joubert from di South African Gunowners Association.
Wia Bekkersdal, di township wia di South Africa shooting happun?
Di attack happun for Bekkersdal, one township about 40km (25 miles) southwest of Johannesburg, close to some gold mines for South Africa.
Di gunfire happun near one tavern, according to reports.
Bekkersdal na densely populated community wey don face high levels of poverty and unemployment.
Dem establish am in 1945 to house South Africans, wey dey work for nearby towns and surrounding gold mines and dem give am municipal status for 1983.
Di township get history of unrest and na di site of violent protests ahead of South Africa general elections on May 7, 2014.









