VIDEO: Obaseki arrival for Inec office, wetin police do and APC reaction

Wetin we call dis Video, VIDEO: Obaseki arrival for Inec office, wetin police do and APC reaction
VIDEO: Obaseki arrival for Inec office, wetin police do and APC reaction

Edo state govnor Godwin Obaseki go di Inec state collation office for Edo state.

Wetin e go do dia neva clear.

Dis na afta tori of allegations of rigging wey PDP di ruling party for di state accuse some officials of di electoral commission.

All dis drama dey happun around 3am inside and outside collation center ahead of di planned collation of results on Sunday morning.

While di DG of di Asue/Ogie Campaign Council, Matthew Iduoriyekemwe claim say Inec dey rig, Senator Ajibola Bashiru wey be di APC National Secretary say dem go react if Obaseki no comot from Inec office.

Na heavy police shield Godwin Obaseki comot for Inec state collation center around 5am.

Inec neva tok anytin.

Edo pipo dey vote who go be dia next govnor - di three main candidates na PDP Asue Ighodalo, Monday Okpebholo of APC and Olumide Akpata of di Labour party.